Story: Adanna!!! (18+) - Season 1 - Episode 14

Episode 8 years ago

Story: Adanna!!! (18+) - Season 1 - Episode 14

Well i wasnt that surprise to see her, honestly i saw glimpse of it, but i need to know what she is and i need to hear it from her mouth, in order to reduce my thinking i order for one bott’e of star even though i nor dey drink before, but this time i need something more than hot, and since i dey the right place i just cucuma start drinking without thinking.
Guy 1: chelsea go beat man utd
Guy 2: go sit down who know chelsea.
Guy 3: guy forget that thing oh you know say we get costa now.
Guy 2: forget about costa phil jones go pocket am.
Guy 3: haahaha who know phil jones, even though self e fit pocket pocket costa what of fabregas?
Guy 2: fabregas wey dey lost for match, nobody go pocket am e go pocket himself.
Guy 5: man united na only talk una sabi talk, no bi small arsenal beat una for F.A cup and na una welbeck even score the winning goal,
Guy 2: forget that one, arsenal no fit beat us again, we just dash them welbeck because im leg na biscuit, na so so injury im dey injure.
Guy 1: guy shotup you too get mouth after we beat una finish na, you go keep quiet like mumu.
Guy 2: thunder fire that na head wey be like were train dey pass go london for calling me mumu.
Guy 3: thunder fire your papa if na cause.
Guy 2: guy na me you dey talk to, look me well oh i resemble your mate, because of say i sit down here with you you come get mind to dey yarn for were big bros like me dey talk.
Guy 1: abeg shot up for there, wether you be old man or not, so far me and you dey here together we be mate.
Guy 2. If you nor shot up for there na i go para this bottle for your head, you dey mad you know who i be
Guy 1: guy u nor fit do more than a dead rat, do your worse (standing up and pulling his shirt, ready for fight) the other guy took star bottle and throw it at the other guy, the bros bend down and dodge it, the bottle flew and smash the back of my head, i didnt even feel any pain at all, no injury nothing at all, after i check the back of my head i see say no blood, no scratch and no sign of injury, i stood up and ask.
Me: na who be the person wey throw that bottle.
(before i they talk finish the bar don empty)

Previous Episode

Story: Adanna!!! (18+) - Season 1 - Episode 13

Next Episode

Story: Adanna!!! (18+) - Season 1 - Episode 15

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)