Story: Adanna!!! (18+) [COMPLETED] - Season 2 - Episode 13

Episode 7 years ago

Story: Adanna!!! (18+) [COMPLETED] - Season 2 - Episode 13

I sit down for inside house i don finish one plate of rice na the
second one i they now, heavy rain they fall for outside and the time
say six thiry in the evening, Blessing stay ground they watch movie
since nothing to do na so fan they blow and light they shine for up,
sometimes i nor they understand Nepa oh when rain they fall no be e
them suppose take light? But na now light they scatter for ground well
na them sabi sha na them know how them they run their thing.
Me: Ble how far.
Ble: i they oh you don finish am?
Me: yes oh abeg you fit bring come again.
Ble: Jesus Christ na tank they your belle?
Me: no be my fault na the food sweet na.
Ble: me i never chop oh food don finish for pot.
Me: abeg na you go cook another one na.
Ble: just carry the pot for there and pack stew put.
Me: thanks love.
I go where she put the pot and took it i annex stew put and went back
to my sit and sat down consuming the food like say no tomorrow, i dont
really know whats wrong with me anytime i see food wey sweet i nor
they think of tomorrow i just want finish that food that day.
I finish everything on the pot you wont blame me now would you? after
all i never eat afternoon food so na afternoon own and evening own i
eat so, na only night food remain (i believe 80 percent of nigeria
student eat night food).
After consuming everything i kept the pot for her, i look outside and
see say the rain don they stop small small i went inside and sat down
again looking at her big ass like that of Mercy Johnson, her own nor
too big like Mercy Johnson own sha Mercy Johnson own na Elephantiasis.
I join her on the floor and we watch movie together, shes watching one
old America film titled Tarzan, wey Jane go they call Tarzan e go be
like say she they call cowbell (na her tongue sha).
We watch movie till 7, 8, 9 before rain gree stop i wanted to sleep
but i know Blessing wont agree so the best thing na to enter this
kpotokpoto road they go house, she escort me reach her street road
before she turn back, everywhere don dark as if na twelve midnight we
they though light they shine for everywhere but i still they fear as i
come out for Blessing street i meet two road, the one on my left lead
to my school and kpotokpoto go they road well well, the one on my
right lead to main road thats MCC road, so i decided to follow that
road because light they road and the road them tile the road also, na
there Adanna first for meet me when i they go come Blessing house now
i they commot for Blessing house and i hope and pray no more Adanna,
any Adanna in my life i rebuke in Jesus name Amen. (did i hear you say
Amen)
I was walking silently to the main road i cant walk fast because i
will fall i use my infinix phone as torch i walk for two minutes
before i reach MCC road, as i reach there i turn left they go the
junction na before the junction you go meet my house because the road
they tiled i begin waka fast though kpotokpoto still they enter my leg
and rain still they shower small small, na to reach house and enter
bathroom sharp sharp.
I was walking fast till i get to burkingham college everywhere they
quiet and no sound anywhere apart from that of owl and the raindrop,
as i was going to my house at my front i saw people coming towards me,
though them they far i never near them at all them be like five to six
guys like that them hold something for hand, i nor know wetin e be i
wasnt afraid because na guys like me, though that boldness disappear
when i saw that the thing they hold on their hand is gun, when i see
it i first pause then i jejely they waka go back small small, them
they waka fast come meet me omo i gat to run oh e be like say na me
them come for, i ran inside between two building and i hear them say
“stop there” thank God say i know this area well well, i enter one
corner for there and burst out for one big compound wey i fit follow
go umuojima road i begin they go Omuojima road where that big erosion
they, i think say i sabi road i nor know say i be ju as i they comeout
from the third building i saw another guy with heavy gun standing on
my front backing me, i quickly turn back but as i don pass the third
building they go back i they hear the footstep of the guys wey they
follow me they come, omo i dont know what to do oh, i they between one
big building and one small one like student building though before
them fit see me them need to search five houses wey they that area
and e no they possible, so i decided to hide in the back of the second
house, as i they waka they go somebody for the first house open door.
“come inside” I was shock like hell because i dont know the person.
Unknown: if you want to live come inside now.
I dont really think i have a choice oh i have to take the risk so i
follow the unknown to the room, i enter the room and the room they
very nice, she on her rechargeable light and yes i remember her face
the new girl. (Beginning Of Story)

watchout for part 14

Previous Episode

Story: Adanna!!! (18+) [COMPLETED] - Season 2 - Episode 12

Next Episode

Story: Adanna!!! (18+) [COMPLETED] - Season 2 - Episode 14

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)