Must Read: In The House Of God - Season 1 - Episode 42

Episode 7 years ago

Must Read: In The House Of God - Season 1 - Episode 42

I was surprise to see the guy lying lifeless on the ground i ask
friday what happened.
Me: guy wetin happen na?
Friday: nobody mess with us and go scot free.
Me: so you mean na una do am?
Friday: to make you feel free because him for return.
Me: una weldone i be they even look for am make we finish wetin we
start, what of the other guy?
Friday: we nor fit see that one oh.
Me: we go find am together, wey the rest na?
Friday: them don go shayo for one corner make we go join them?
Me: oyaa na since nothing to do make we enter there na.
We left the place were everybody gathered looking at the lifeless body
on the ground i guess the police will investigate the crime but na
them sabi e no concern me, me and friday left and enter one bar like
that there we meet other of our guys smoking weed and drinking, they
were five like that and when they saw us we greet each other before
joining them, the bar big and everywhere is filled up, we just they
one corner they shayo and me i request for small stout but i refuse to
smoke weed because i dont like it, we are five with only one girl on
our midst the girl sit close to our capon smoking weed.



Me: bros na wa oh the way una just leave me for that hostel why na?
Guy 1: na the koko be that.
Capon: e mean say you be badoo for you to receive beating then them come sU-Ck
you dry and you still manage go house that qualify you as a brother,
All Hail The Red Sonja” (he raise his bottle of stout up and we all do
the same and toast, we finish drinking then we start singing our
anthem, the capon and the rest were dancing around the table but me
carry bottle use am they beat drum to make the song sweet, i really
enjoy been in their midst, when it was around 8pm me and friday left
them there i nor pay any money but i believe say capon go pay, i drink
three stout and i guess the think don they shack my head, we enter 175
road begin go house as me and friday they go house we pass one fine
girl, she waka pass us and the way that her yash they blow groundnut
fit put person for wahala, i thought i was the only one that got hit
by her a-s i nor know say friday they reason am too.
Me: oh boy see that a-s?
Friday: no be here see as e send spine for my body.



Me: make we go stop her na.
Friday: no need she they always pass this side go work since she don
go far tomorrow evening we go come block her i hope u don for the
matter.
Me: i go try my best na.
We continue gisting along the way when friday said that he need money
oh that hes running shot of money.



Me: you nor they work?
Friday: for where my madam sack me last week him say i they steal her money.
Me: hahahaha na which kind work?
Friday: na gateman oh for one big madam compound.
Me: hmmm so she get mind sack a whole you.
Friday: we nor get choice na even though i fit do something chance no
they because na car she they take commot for compound and return.
Me: wetin you be want do?
Friday: i be wan block her for road, thief her money na.
Me: she nor go arrest you.
Friday: for where we go wear mask na..
Me: na only you go do that one no be me go join you.
Friday: guy you nor know say me and you don be squad?
Me: to they theif?
Friday: na just for fun na since we have the power lets use it just
like the politician are using theirs.
Me: (hmmm but come to think of it i will soon return to Edo state and
am not even having fun yet, stealing will be a good way to boost my
morale) but we nor get weapon na.


Friday: forget that one na small thing to get.

Me: so you mean you fit arrange one?
Friday: yes na, during election last time parties pack guns give us
and na im we they use carry out operation now.
Me: na wa oh so na politician they give una gun.


Friday: na so na, and na the right time to start use the gun because
xmas don they reach we need money.
Me: but na two of us na.
Friday: na everyday them raskamacy they carryout operation oh.
Me: really so cultist they thief?
Friday: if we nor theif na where we go see money they pay for our drinks?
This wasn’t new to me because i do know cultist steal but i dont know where
am heading to because joining them to steal is a sure way to boost my
morale but what if am caught, oh well i dont care because i must
revenge Celestina.

Previous Episode

Must Read: In The House Of God - Season 1 - Episode 41

Next Episode

Must Read: In The House Of God - Season 1 - Episode 43

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)