Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 41

Episode 7 years ago

Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 41

I entered inside our flat and all my friends
were already waiting for me
Kay: Chairman……………….Powerful chairman
Micheal: Na the oga be this now ooo
Gbenga: Hope u bought milk on ur way
coming…………….cos I know say u go don loose
too much energy today, e no easy at all after
so many months without s-x
Kay:Hope say u use condom sha cos this one
no be shade ooo
Gbenga: Baba ooo……but wetyn make u late
now, u follow the babe go house?

Me:which kind house, jst gisting at the bus
stop ni……………..


Gbenga: But that babe make sense oo……
Micheal: I no say as she fair nah in her K---y-
Cat sef go fair cos her complexion no be from
here
Kay:lailai…down go dey dark..na bushy area
now…how d tyn take b?
Me:Na clean shave now…..no traffic at all
Gbenga: baba ooooo…..u suppose wash am
for us ooo
Me:wash wetyn now……………………..
Gbenga: ahn..ahn……………you are welcome
to the league now, so u suppose carry us go
shaye for iya uche place
Kay:na tru ooo..we no go even spend reach 5k
sef…wetyn we wan drink
Me:una dey craze..bleeping na achievement
Micheal:Na achievement for your own case
ooo…..how many months now wey u don do
am last
Abimbola: Nonsense…………….(she hissed and
walk inside the room)
Kay:wetyn dey do this one now…u no even
happy for your guy say e don break the jinx
now….


Gbenga:No mind the babe, sebi snakie dey
beg am for babe all this while she dey do
shakara, the guy come run hin own package
now she dey hiss dey call am nonsense…..
Me:I even dey hungry sef
Kay: E reach like dat my
chairman……….Abimbola, abeg prepare food for
us to eat ooo, your children are hungry
Abimbola: Children should go and drink water
Me:water ke? Abeg no do like that oooo
Abimbola: Who dey talk to u? u wan eat
poison? U go just die for notyn…….bird of
same feather
Gbenga: wetyn happen now Bimbola…….Na
fyt?

Kay: I no no 4 am oooo
Abimbola: even if I wan cook for everybody,
snakie no dey eat my food again ooo
Me: wetyn I do now….na beg I dey beg pls
Tunde: why u dey beg am now……………….
Micheal: hin need d food dis nyt more dan
any other day..so, he gatz beg
Abimbola: If snakie dey eat den I no dey cook
again b dat…………….
Gbenga: up to dat?
Abimbola: e even pass dat sef…………….Ashewo
oshi
I left them in the sitting room to take my bath,
I finished with my bath and Abimbola was
already in the kitchen….food was ready in no
time, she served everybody and didn’t give me
any food..i went to the kitchen when they
started eating to dish my own food….i was
putting food on my plate when Abimbola
rushed into the kitchen and collected the food
from me……………

Abimbola: Na u cook am? Why u no ask your
girlfriend make she cook 4u before she go abi
na me collect all ur energy……………….
Me: Pls now…no do like dat now
Abimbola: Like wetyn……………..Monkey dey
work, baboon dey chop am
Kay: Who be monkey and who be baboon
Abimbola: I no no 4 una oooo…….i go dey
cook for una and una go dey waste am to
somewhere else, I no even expect am to this
snakie, I thought he was different from you
guys before but he proved me wrong
today….As from today ehn, any day wey any of
una bleep any lady for this house aside una
main girlfriend, no food for that person for this
house dat day……………
Micheal: oya now……Mama don talk….una don
hear ooo
Me:Atleast make I carry dis one now, sebi na
today u make the law
Abimbola: e don start today b dat…



I realized Abimbola was not joking with me
even though my other guys count it as joke
cos on my mind, I know she wont be happy
with wat she saw. I picked another plate and
she collected it back from me, I was looking at
her with pity as she stared at me with a
strong face….i drew her closer with my right
hand placing her back on the wall with a kiss
to her lips forcefully, she removed her mouth, I
knelt down holding her bottom
Me:Pls am very sorry Abimbola, I will explain
everytyn to you when we are alone
Abimbola: Sorry for yourself abeg, I don’t have
your tym
Me:Pls am sorry now babe
Abimbola: Notyn to be sorry about, I thought
u are different before but never know u are the
same thing with other guys……………………



I could feel it as tears wanted to started
rolling out of her eyes, she clean herself,
adjusted, pushed me away and stepped out of
the kitchen. I dished my food and went back
to the sitting room. I tried to talk to Bimbola
later in the night when we were a bit free but
she never gave me any chance.



I received a text message from Labake later in
the night telling me she cant wait to see me
tomorrow that she was missing me
already………….(When one door closes, another
one open)

Previous Episode

Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 40

Next Episode

Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 42

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)