As i dey come,i branch Eleniyan15 electrical shop.buy this disco light bulbs wey no day white, wey day usually day club. i buy one red bulb and i buy one blue bulb.. .
I no forget also branch Dj abiambo Syd. Na there I buy two collection of blues and romantic Foreign songs.At least person no fit day play Terry G nack apako for insyd dat kind parol naw.. .how body go even move ??
Choi.i no get music player naa ?? How i wan take do am.i sharply rush go Trishguy house go, borrow him sound system.2 k na him d guy request for..
2k too much naw ??
” Take it or leave it ?? He said.. No be today i sabi say d bastard stingy with money.
Shebi na just 2k…Na 40k i go win if i tear dis girl oo.I pay d guy carry d speaker go ??
” he no day spoil oo,na my papa hand i inherit am oo ”
” Your father yansh, if he spoil shey i no pay u… ..
i carry the banner wey i buy. Plaster am for wall in a position wey be say na d first thing wey she go see be that..Hehehe half Unclad women in bikini.that will send her d signal say look ” You are here for business”.
But wait,Gen nko. .in case light no day ??? i go
TechsNg house. dem say he don go school.lock hin gen inside room.
Oh wetin be this one naw. I sharply go one of the holy holy guys wey day hood, djeezy. …The guy na very cool guy,he no day smoke.drink or fornicate and na pastor hin be. I sharpaly formulate one lie give am and he agree give d The Gen with d Assurance that i return d thing d next day.
While the guy day go sort out d Gen for me.i see say na pastor Chris oyakilome day preach for hin phone and d topic na ” S#xual prosmicuity “.
Dont sleep with that girl.. The Bible says in d book of something something something ..that …The woman lures the man.. ..the kini kan do d man..
Mtcheww..Everything wey d man just day talk be like jargons to me..This message is not meant for me..No be me get am..If God no want make i kpansh inchinbong.he no go allow her change her mind and come my side..
Abeg pastor Chris abi ludacris ni,Swerve go one side abeg.i just use Vex comot d man video comot.Shey dog wey go lost. No go hear hunter whistle.
Related episodes
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}