Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 10

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 10

MR. Awotunde just enter the room with two gun for him hand, as he take sit down for chair wey face me and my yoruba love. Hmmmmmmm! My mind fly con lost like Malaysia plane, that cold wey dey make person update weather for two catch me. Me no even know how the thing they do me, I need to chop better liver, dat kind one wey Mama Chika dey sell or else my matter go turn Story for the Gods. “We meet again, but this time in a decisive moment” Mr. Awotunde dey yarn. Na so we see am *Seyi just gum for my back*. “I have an offer for you, this is something that would change your life” Mr. Awotunde dey yarn. Na wetin be the thing. “I want you to join my team, bring justice to its call” Mr. Awotunde dey yarn. Dat one no fit happen, I be one man mopol. “Well this is the opportunity……” Mr. Awotunde dey yarn. I no let am talk finish because plenty talk no they full basket. Na so I quickly shoot am before he go think about am, na there I know say na only me waka come. My gun just sound fiak!, bullet done finish oooo. “I told you before, you won’t see it coming” Mr. Awotunde dey yarn. Na so he take shot me with the gun wey dey him hand, na eem me self fall go ground.
*******************
My body won peel, as I fast remove the bullet proof wey save me. I use eye find Seyi, I no even see her, even Mr. Awotunde. I con run go outside, as I take see as motor wey them they.

I con pick two gun for ground, as I pursue the motor with my leg, na eem I con reach were my power bike dey. Me just tear speed as if na Etisalat Easy Blaze I subscribe. I burst enter express as I take they fire pursue them.

I divert go left this man block, I follow the other side na still the same thing. Na so I vex turn Ghost Rider, as I put speed wey na only one tire I stand with. The skills wey I do, make me pass am go far and I dey sure say he no see me again. Me con face am they drive come back as I hold my two gun for hand, na so I take shoot the two front tire at once. But na God save am because he don already slow down na so he crash go one side of the road. Me just waka reach were he dey, as I come down from the power bike.

I just reach there, I open door con give blow for head na eem he take catch my hand, as he take knack am for staring, he still con punch me for belle as, I fall go back. Na eem we take position like say na May weather vs Manny Pacquaio. The punch no be here as we take dey exchange am with flash share, he give me and I give am. Body no need to remember wetin ee dey collect, as I take dive am go ground. Me just dey untop the man dey pound am with blow as is na akpu, na so he take something take knack me,n I no know wetin be the thing as I take fall comot for him body. The next thing wey I see na the man carry gun face me, as I look left and right nothing wey I fit use take save my self. Na so my dream won take come thru, me just say my last prayer as I close eyes…POH!!!!!!!
*******************
… I check my body bullet no touch, oo! I don turn superman. Me con look up the man just fall go one side, na my yoruba love I see wey stand with gun. Her body dey shake, na so I waka go meet her. “Ololu fe mi, mo ti pa eyan *my love I don pia person*” Seyi dey yarn. No na, you just save my life. She just dey cry, me con pet am as she take climb my power bike, we con zoom comot.

Wen we reach na her place we go straight. My mind just dey sweet me like pikin wey dem dash packet of sugar lick, as I done reach there, see as people just dey hail me…BIG_T!…BIG_T!!…BIG_T!!!…my head just dey swell as if na me go rescue those missing girls. Me just go collect better bathing as I run go make call… Hello mummy. “Hello, have been hoping to see you ever since” mummy dey yarn. Abeg no vex for me, how my old boy body. “Well, we are lucky, he is still here with us, just taking few medications and then he would be discharged” mummy dey yarn. No worry me go come house soon. Me just dey happy say everything turn out well and thanks to my behind the scene guys and my yoruba love. As I waka enter my house na so nepa bring light…

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 9

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 11

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)