Suliat don give u love p’ortion chop oh, u no go gree na, until e clear comot for ur eyes, na dat time u go gree” i said to Sammy as we were all seated outside(except Ilorin) one afternoon. “ehn leave am for me, i love my babe, na ur concern?” Sammy responded.
The kind of Love Sammy suddenly developed for Suliat was really a matter of concern to all of us. Whenever she comes around, Sammy does the cooking, Sammy washes not only her clothes but her u’ndies too. The both of them had practically turned Husband and Wife bcos Suliat stays in Sammy’s place 24/7. Sammy hardly spends time with us. Suliat had not only cast a spell on him, but She was also remote controlling him. I really pitied him.
“we don dey tell u now u no wan hear, fly wey no dey hear word go follow dead body enter grave oh” Angom added. “na u go follow dead body enter grave” Sammy responded f’oolishly. “u wan end like Ilorin abi? See as him dey run, now him don travel go Ilorin go hide, police dey find am, Tola mama don go report am for our secretariat, him fit repeat him service year oh” i said, “abeg!! i no fit be like Ilorin jor, i love my Suliat and my Suliat Love me, e no concern una, i fit marry her sef, abeg una dey talk rubbish, na jealousy go kill una” Sammy said walking out on us. Kelvin also walked out saying; “e be like say my food dey burn, make i go check am”. “ur own no pass to dey cook, No burn Mama Alhaja house one day oh, every morning, afternoon, and night, u dey cook, even for ur dream sef, u dey cook, take am easy oh” i said. “like say if i give u the food wey i cook, u no go chop?” he responded. True talk, if he offered me anything he cooked, i must eat, bcos he was a good cook.
As I and Angom was left seating outside, i said, “today na Tuesday oh, Blue Angels day oh, make we go see how much we go hustle for our Sugar Mummy runs na”. “we go go na, na now wey we go soon serve finish nahim we need money pass oh” Angom said.
Just when i was advising Sammy concerning his relationship with Suliat, not knowing my relationship with Ireti would soon bring doom
Related episodes
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}