Must Read: Thorns In My Boot

Episode 6 years ago

Must Read: Thorns In My Boot

Hmm,I understand your situation Ojo, he said; this na my twenty three years for this Prisons work and I don serve for eight different Prisons all over Nigeria so my eyes don see plenty! Your case no be the worst o! At all, at all! In fact your case better pass plenty People own. No be People dey for C.C cell? Thank your God say you still get hope of leaving here someday. Thank God say you get sound health, you dey fit to eat and drink, you dey even smoke Kpoli! Old boy! I don see cases wey worse pass your own well well! You wey dey inside Prison and you still dey do business, you dey complain!

Oga Inside! I interrupted; wetin be the importance of the money wey I dey make when my Mama, the only Person wey I get for life don kolo? What is the use? I asked.

The use be say, you still fit use that money to cure her and take care of her! He said; but if you use your money to smoke Kpoli finish, how you go take carter for your mama medical needs? How you go take settle your Lawyer? Even me wey I dey here with you, you think say na because I like you? I go run from you I swear!

You mean am? I asked him.

Before nko? He asked; no be quarrel me and you dey always quarrel before? Abi you don forget? The reason I dey close to you na because you dey settle me o! If not, wetin go make Warder and Prisoner sidon together dey share Kpoli smoke? Look! You better wise up o! Stop this yeye habit wey you want to start now before you ruin yourself! Kpoli dey very expensive inside Prison and at the rate you are going, you go smoke your money finish then your eyes go clear! By that time, your case go bad pass your mama own sef!

And that your Barrister! He said; he be like say she like you! The way she dey carry your matter put for head dey make me to wonder whether no be me connect her to you again!

Wetin you mean Oga? I asked
Just be careful not to hurt her or disappoint her by misbehaving or giving up all hope, let her continue to see the drive and desire to survive in you. Stop burning your money on Kpoli! Don’t emulate these Politicians here!
These Guys have chains of businesses churning out money for them outside the walls of these Prisons and abroad. The only source of income you have now is the illegal trade you are indulged in here, and remember that no be everybody like you! Some people dey jealous you already if you must know! But no be everything I go dey tell you! The fact that you are doing business in the Prison does not mean that it is legal and allowed! It is illegal! But we just look the other way, and for your information, the day our Oga or external inspectors will come here and they happen to find out, all of us including me will deny you three times before the rooster crows! So make your money while you can and stop squandering it, because nothing lasts forever!

Before we parted ways that night, we agreed that he contact my Lawyer and together they should see that my Mother is brought to a Psychiatric Hospital in Abakaliki. From then we shall know the way forward.

I will forever be grateful to Oga Inside for our discussion that night.


Oga Inside did not embezzle my money, although he had used up some of it for family issues but he promised to pay back.

The balance of eight thousand naira with him he had deposited into my Bank account, he brought back the deposit slip to me for keeps

Previous Episode

Must Read: Thorns In My Boot

Next Episode

Must Read: Thorns In My Boot

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6