SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 2

Episode 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 2

☆☆

Omo see gobe na, na real wahala we buy for platoon 10 and 7. See big job na, chai omo see as dem just dey role, frog jumping, pinning of head. Omo three people from platoon 10 don faint chai na real gobe be this. I come start to dey pity dem {pity dem ke? As if na me send dem to f--k up?} , sha na dem buy am afterall na dem start all this wahala so na their cup of tea be that sha.

I just dey watch dem like film dey go, just then the camp commander come show. Oboy i know say show don spoil for dem especially platoon 10 cause na through their oga dem start to rebel and and the camp don must avenge today.

But what about platoon 7, but wait o- platoon 7 na the camp don platoon so make i just dey observe dem well.

Later dem come order provost to tear all platoon 7 dem 5 lashes each and platoon 10 dem 10 lashes each. The later’s lashes was as a result of their rebellious and destructive actions couple with the missing food while the formal’s was just because of the missing food and disorderliness.

Omo na the provost dem i pity cause to flog all those battalion is not a day job o. Sha the provost dem dey undergo a training so dem be professional floggers.

Suprisingly , the provost were through with both platoons withing half an hour.

Na from that day i start to dey fear these provost dem like mad.

At exaltly 12pm, punishment don finish so both platoon 7 and 10 dem return back to their hostels. Every one return back to their hostels awaiting the call for the almighty jungle survival training.

We dey our quarters dey gist about the latest in the camp when we heard the whistle i turn and take a look at the time. It was 5pm dot,

“yes this is it boys , no going back”
i murmur then we all dashed out of the room to the parade ground.

On reaching the parade ground we were ordered to stand according to our order {by company, section and platoon}, within 10 seconds it was form. Trust me, nobody want to be a scape goat so as to taste the provost koboko, if you were in our shoes you will understand, {laughs}.

Just then the camp don come show and i knew that yes anytime from now, brutality will commence….

Previous Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 1

Next Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 3

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)