SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 5

Episode 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 5

☆☆
TRAINING
STAGE 2


As soon as i dey cross the first stage line enter the second stage, na so dem come tell us to start side ways roll. Chai omo na so side ways role start o . We start to roll inside the dirty mould dey go just then each provost dem come show start to dish out koboko like say we be maluus {cows or namas for short} na so people just dey shout sorry dey cry at a time.

Omo me see something i no fit talk o. Cause me wey dey make mouth like buhari come do like frighten chicken. We continue side ways roll as the koboko self dey tell us grammer. But me no know say yes na the real gobe i dey enter


TRAINING
STAGE 3


As soon as i dey complete that stage na so i tear race commot o, even usain bolt no be my match cause i run 5000 kilometers per seconds {abeg make ona self try to understand. Cause the koboko pain die}.

Once i just cross enter stage 3 line, na so up to 5 or 6 provost dem come gather me like thief, chai dem really carry me demostrate wetin nigeria army soldiers dey do bokoharam boys wey dem capture. Me just mumu like goat stand thinking that i fall law, when i come realise say boy here na the flogging stage aka koboko zone na so i tear race just then i come clash with abacha {abacha na provost also}chai once i just realise say na abacha, i started confessing all my sins to God incase i no make am.

Previous Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 4

Next Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 6

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)