SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 11

Episode 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 11

☆☆

As soon as i hear am- i was like a what the f--k is this guy trying to tell us, how dem expect make person use peppery food hand rub for bare head. Chai see gobe and wickedness of the highest order.

After the miserable eating session, we were told to rest for 20mins, where you expect make we rest, na for mouldy grass, sand and water ofcourse. Me just fine one place for the mouldy water lie down inside, {like seriouse? It was a paradise in hell}

i was fast asleep cause atleast make i rest well in order to prepare for the training ahead. I just lie down sleep o nothing concern me with the environment.

Na waiting wake us from sleep na one heave thud nai i jump up, guess what?


☆☆


Men na one provost wey sleep atop a used nai land o. Chai no rd laughter na, we laugh the provost so tale…….fast forward……

I just lie down again come resume my sleep but then i come decide to check time, omg! The time dey tickle 1:00am dot, but why dem never still wake us up na, hmmm na only dem know o . So e no concern me as long as i fit rest well.


“Oga spoonz”

person call me, nai i turn round come see ema, chai ema ema my padi, since the day after we show for camp i never take eyes see am , but now see where we meet. I just scan all over the guy , e shoe no dey , na nearly boxer trainer e wear, e face don swell as as result of dirty slaps.

E yansh no get shape again , chai i nearly laugh out. Just then i come ask am
“ema why the hell did you take off ur shoes?”
e just laugh come scan me with e eyes come ask me

“and why the hell are you dressed like a chicken?”

kai! Tuale kasara don burst , na me this guy dey call chicken? Wait make i first transfer all my pains on him when i return i go continue wetin happen for episode 12
.
.
.
.

Previous Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 10

Next Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 12

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)