SEVEN DAYS TO MAKE A MAN [completed] Season 2

Season 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN [completed] Season 2

☆☆
…….
As matchet just land for shekeau neck nai shekeau come shout, just then i come feel a very sharp blow for my hand nai i come jump up


“guys were shekeau were shekeau i don kill shekeau, were ona hide am”


just then my eyes come dey clear, nai david come shout


“make thunder fire you there, so na me be the shekeau you won kill, if na my village witch send you come, go back go tell dem say you no see me o”

“haba, david wetin i do you na?”
i manage to ask amid confusion


“guy you pin my head come raise your hand like sword of mousquiteers slash my throat, abi dem send you?”

“abeg my guy no vex o, na dream i been dey dream o”

“you mean am?”
solomon aka solo cut in

“yes o bro”

“oya na yank us, the way i see am e go dey rugged”
samuel aka sammy cut in
i come yank dem all wetin happen nai the boys dem come dey laugh when i tell dem say i was a captain, nai dem come laugh say na spoonz dream i been dey dream. Omo from that day nai dem come nickname me spoonz.
Just then i come remember something, nai i come check time, omo the time na 10am, we don late die, nai i come run go baf come back wear my training attire won run out when david come call me back


“spoonz where you dey chook head?”
“who be spoonz?”
i manage ask even though i knew


“na ur grand papa”
he retorted


“make devil s--t for that ur smelling gutter you call mouth”

“just as e dey s--t for your own abi? Anyway where you won chook head?”
he ask with a wicked glee


“i won go chook head for ur grand papa yansh , idiot”
i replied him with the same evil glee


“na wa for children of now adays o, dem no get manners at all”

“then me no know why ancient children like ona no go ever leave us”


just then solo came in, {the guy been go out after the incident} seeing me in my training attire, he ask


“spoonz, shebi na training you won go?”

“yes bro ”

“guy rest jor, if to say dem won start dem for call , dem never call”

“wetin happen?”
i ask him
“guy na platoon 10 and 7 punishment things on point o ”
“you mean am?”
“yes o, na their punishment give us free break o”
“guy make i run go see am”

i ran out to the training field, omo wetin me i see i no fit talk, platoon 10 and 7 dey inside gobe, na real job we help dem buy.

Episodes
SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 16
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 16

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 15
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 15

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 14
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 14

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 13
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 13

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 12
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 12

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 11
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 11

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 10
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 10

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 9
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 9

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 8
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 8

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 7
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 7

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 6
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 6

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 5
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 5

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 4
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 4

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 3
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 3

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 2
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 2

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 1
episode | 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 1