Read Story: SEASON 1 EPISODE 4
Andrew-haah shey one of those girls forget their pant
Me-if that one be the bad news dey for don roast me give dog chop
Andrew-aaah me too i fear ooo,so wetin be the bad news
Me-they say make i go learn generator work
Andrew-(laughing)
Me-why you dey laugh she e funny
Andrew-(laughing)
Me-andrew you dey waste my card if you know say you wan laugh wella make you come my side so i go punch your teeth
Andrew-(still laughing) my guy no vex the thing just funny,so as work plenty outside wey you fit learn na gen work your papa see give you (laughing)
Me-i swear if you laugh again i go cut this call
Andrew-oya no vex lets be serious, so where you wan learn am
Me-me sef i no know but na big gen i go dey learn how to repair
Andrew-shuu so na big gen,money dey there ooo! why you no tell me say na big gen
Me-shey you give me chance to tell you when you where laughing like one mad jackal
Andrew-no vex joor but i swear money dey dat business
Me-see bye mtn don dey give me signal
Andrew-i dey come your house
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}