Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 29

Episode 7 years ago

Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 29

Bola was in the kitchen later that day, Kay’s
girlfriend was also around and I went to pick
up something
Bola: What was all were doing in the sitting
room
Me:as in?
Bola:You dey ask me as in? because I no wan
cast u in front of boys make dem no make jest
of u
Me:I no understand wetyn u dey talk
Bola:Ehn..ehn… I go come burst u then
Me:I no say u no go wan do like that now
Bola:Why u com dey deny like say u no know
wetyn dey happen b4
Me:Why u sef dey sample my d!ckson
Bola:Konji na b-----d to God…………………U dey
miss oo guy
Me:I hear u
Bola: äbi make I carry u go bleep ashana?
Me:why now…e never reach that level now
Bola:Guys no go know..we go just do am
codedly
Me:U dey craze…..Thank u, I no need am
Bola:U no need am but with this way wey u
dey go, make u no go rape me or any lady for
this compound one day
Me:U sef arrange me one correct babe now
Bola:sincerely, no one wey I fit recommend for
u now cos u dey reserved but we go see how e
dey go
Me:na wah ooo…na me come turn this
way..even u sef no dey help matters
Bola:wetyn I dey do again now…
Me:U go just dey put person for agro all the
time
Bola:Hehehe…see me see trouble oooo…e be
like say I go dey fear u as from this moment
ooo
Me:wetyn dey do you now…why u com dey
raise your voice , shut up jhoor (spank her
Bottom)
Bola:E gbami ke (make una help me)….wetyn
be all this now
Kay:wetyn dey happen there?
Bola:Na snakie ooo…….make una com call am
commot for here ooo…e just dey tap current
for my body
Tunde:I hope say u safe there sha
Bola:I no sure oo..make una..abeg make I
commot 4 am abeg..e no even want make I
pass sef
Me:hw I take dey block u now………
Bola: Commot for road jhoor…… (she pushed
me away)

That was how she ran out of the
kitchen………

Kay: wetyn happen now?
Abimbola: No mind this snakie oooooo
Tunde: Wetyn e do?
Abimbola:e just dey tap current for my
body……free of charge for that matter
Micheal: lolzzz……….Padi mi ti kun, o fe tu si e
lara pupu ni (My friend is filled up, he wanted
to discharge)
Abimbola:If e want to discharge, na my body
come be dumping ground?
Tunde:You can help a brother now…….snakie
na ur broad now
Abimbola:Una dey craze, una want make hin
kill me with that big rod wey hin carry 4 that
place
Kay:Which kind big rod, u don c am before
Abimbola: na today?i wish una fit see how the
tyn stand inside kitchen now……….
Tunde:Talk tru bimbola, u feel the thing abi u
don feel am b4
Abimbola; U dey craze……….
Micheal:U no even fit risk to take am once
Bimbola cos if u do, wallahi u go divorce ur
boyfriend
Abimbola:I no even fir try am…..shade wey
take am sef try…the babe na master
Kay:Snakie oooo….hmmmmm, ekun
Me:which kind nonsense be all this one
now…..abeg make una talk another topic jhoor
Kay:y u sef dey go tap current for Bimbola
body..take am easy o guy
Me:U dey craze……………
Abimbola:Sincerely, na so e remain, snakie
don almost start to press my bobbie
Micheal:lolzzz…..File, how the bobbie be
snakie
Me:and una dey believe wetyn she dey tell una
Tunde:If u no touch her she go shout
Abimbola:Thank you jare Tunde…………I even
dey fear am now sef, make e no be say one
day una no go day and he go r.ape me inside
house
Kay: na to dey wear iron trouser anytym u dey
house with am b that….
“laughter everywhere”
Me:Una no serious………….All of una dey craze
with due respect.
Me:wait oo…e be like say I dey hear noise from
outside oooo
Tunde: Ehn..ehn
Micheal:Neighbour and his girlfriend don start
again b dat
Me:which kind person b this guy sef, wey go
just dey beat his girlfriend up and down
Kay:how that one take concern u…Na love now
Me:love ke? I just hope say dem no go kill
each other for inside this compound one day
Tunde:e concern us
Me:All of una go just dey do I don’t care on
top their matter..e no good ooo
Abimbola:How e take concern our life
now….na wetyn dat geh eye dey find e see
Me:U wey be woman no suppose dey talk like
this now
Abimbola:I no send her mama now….na 4 the
guy to kill am go make me happy sef
Me:e reach like that Bimbola
Kay:na wetyn go pay her be that now..u no
say she her d babe no dey talking term
Me:wetyn happen?
Tunde:Dem dey beef each other unto say the
babe dey feel say Bimbo dey yansh hin
boyfriend
Me:lolzzz
Abimbola:Una no see me, even if I wan yansh
somebody, na hin boyfriend e go be? Wen
guys yapa 4 here
Kay:File…..maami
Micheal: mama oooo………make we enter go do
one round now abeg
Abimbola: U dey craze, e be like say u wan die
there abi…na where u follow come u wan
follow go back
Abimbola “Leave me oooo Micolo, which kind
thing be all this one now, Ahn…ahn….u don
dey press my b---m ooo……….this one dey
craze ni, I go cut ur p---k oooo……”

Kay “oshey micolo…oya make una
enter…….enter the room…..i don open for una”
Abimbola: I go knack stick for ya head
ooooo…….
Micheal : Stop jhoor Bimbola, your hand don
dey go near engine room oooo……….oya pls…
pls pls abeg before you put me for agro
Abimbola:sebi na u wan do something now……

craze boy, na only snakie be gentle guy among
una
“she came to sit beside me”

Previous Episode

Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 28

Next Episode

Must Read: Single But Living Married - Season 1 - Episode 30

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)