Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 4

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 4

…open the door I wan vex die wen na dis my neigbour dey disturb my peace like epan fly, wetin happen Silas. “Big T no vex oo abeg boorow me that ‘2 Kings albulm’ so I fit play am” Silas dey yarn. Ok I done here but take this 500 take go buy your own for White Store. “Big T you do well oo, God go bless you. My love na one of my padi be dat oo, so make we chop. I almost chew my finger join as I eat finish, the food sweet like wetin dem use Aginomoto join Vedan maggi cook. Na eem I remember say I never call Fumnanya today, I con give my yoruba love exccuse go call the babe. As me and Fumnanya talk for phone for like 10 minutes, she be dey para for me but I don cool her down, wen she say she go like com my place wic I know say ee go spoil package, I just tell her say I dey run some tins for my room wey concern my work and we go meet tomorow.

I use style buy chocholate wey my yoruba love like well, me just open the door, I con see wetin fit cause earthquake for man head, my yoruba love just were only p*nt and bra, dis girl I dey sure say na valentine day her parent agree to do am, because she dey beautiful and dat her behind fit make Timaya feature Beyonce for the remix of ‘UKU’. Next thing she waka come were I dey con hug me, use one hand take lock the door, my mind just dey play blues because ee don tey wen I bang last. “Baby it seems your avoiding me since I came to your …”Seyi dey yarn. I no even let her talk finish as I kiss her soft lips wey be like bread wey don soak water, the kiss just dey cent for the full room wen I hijack her go bed. The wey she dey smile be like person wey win lottery. I pull her bra wey dey hide her br*ast, chia! See as the thing stand like defender wey won block free kick. I start to dey use tongue dey ticke n cirle her n*pple and my other hand dey press the second br*ast, con leak her ear enter her neck, wen my hand don already dey untop her p*nt, dey rub her p*ssy. As I wan pull her p*nt comot she con say she won sU-Ck my d*ck aka ‘spatarcus kill dem all’, her mouth rap my d*ck, my head ring as if na china phone. Time don reach to act part two, na so I part her leg con use my tongue greet her p*ssy, she don dey scatter my hair as if something loss there, she con dey scream oo, na eem I con slot my d*ck small small inside hey honey pot. I rock am well, do differnt style until I pour put for her body.

My yoruba girl just chin gum my body for bed and still dey use my bear bear dey play. My phone con dey ring, na Obehi dey call me, she be church member and my very good friend. Hello oh baby, how you dey na. “Good evening Brother Timothy am doing great” Obehi dey yarn. So na wetin dey for me. “Noting really, just called to check on you and peharps you weren’t present for this thursday service” Obehi dey yarn. Abeg no mind me joor, na work cos am but I go show face for church tomorrow. “Ok, tomorrow is our youth sunday and have a lovely night” Obehi dey yarn. You do well, sleep well oo. Sleep na one kind thing wey fit make person late go church. Morning tins oo, church mode activated, as my yoruba love dey tidy house, me go buy wetin person go chop.

…The service na helele, dat Pastor Deborah dey preach wela but the topic na the type wey won make me close my yoruba love ear, na premarital s-x she dey talk about. Well the day done dey fly as usual, flexing must dey as my yoruba love dey commot today. Na so we ball in enter ‘Olori 19’ Bush Bar Lounge, we drink, swim and con round everything up with better s*x for the room wey we lodge. As I wan dey excort her dey go park, I con use ATM take vommit 10K for my babe as transport, she just reject am say make I no worry, say money full her hand. My mind no sweet but no be her first time she dey do me this thing. Na so we do our goodbye loving kiss for park like say na hollywood film we dey shoot, all eyes on me as I con still dey watch as her bus take leave park.
My wallet swell up and I no get wetin I won go do for house, na so I call Ufusky ma real computer geek, ee talk say he dey one bar like dat make I con hook up there. Ee no too tey wey my yoruba love call me say she done reach her place, we still talk well for phone, join the happiness say she no flash me this time.

After many bottles of beer with one point and kill goat, my eyes done red, the state wey I dey I don high pass Kilimanjaro. I hail my people for table say I done dey go house. Me enter my lonely street, no human being noise at all na just crickets and rats sound I dey hear. “Ogbeni wa si ibe bi *guy man come this place*” areaboys voice. My body no even respond becasue I think say na Olamide song I dey hear ‘Voice of the Steet’. Next thing na just two slap update my status, all the drink wen I done dey drink since clear from my eyes. Na four yoruba guys wey carry igbo dey smoke, dey my front. Na so I remeber the money wey dey my wallet and I need to discharge. I push one of the guys take clear road as I dey run like Usain Bolt, my leg dey touch my head wen I notice say dem no dey pursue me again. As I dey happy na so I go match dog wey dey sleep, see me see gobe, the battalion of dogs wey con dey chase me, fit pursue those missing girls come out for Sambisa forest. Na my run con enter jar two as if na ‘Tunde on the Run’ wey be one story wey I read for secodary school, the guy run oo but for this place na me run pass am. As I won divert enter one safe place na so I go slip my leg, con fall knack NEPA pole.

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 3

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 5

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)