Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 5

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 5

As I open one eyes take survey were I dey, I con notice say na hospital I dey but any way I thank God say I survive yesterday or else nobody go fit talk the story of Big T as ee take happen. The ward wey I dey, plenty face wey I recognize dey dere like few of my compound people, Irumole and the won wey surprise me na Fumnanya. Later some of them discharge wey I don manage stand up. Na eem Irumole update me wetin happen, say dem rush me come the hospital early in the morning, say na now I just dey wake up. Fumnanya just sit down near me after she go call doctor con do check up for me. “Well young man you are deemed free to be discharged, due to you were unconscious and also sustained little bruise on your leg, and this are your prescribed drugs for you” Doctor Chinwe dey yarn. Na so Irumole con pay the bill for the hospital and still drive me and Fumnanya go my place. Na so for motor I just drop all the things wey happen to me to them. I con call my yoruba love so I fit explain everything wey happen to me for phone, she no too para for me. When I reach compound, the sorry wey dem dey rain for my body pass the won wey them tell Brazilian players after Germany beat them 8:1 for 2014 world cup. When me open door, Irumole con say him dey comot, dat one no be problem and say he do well for me.

I dey lie down wen person knock my door, na who dey dere “it’s me Fumnanya, can I come in” Fumnanya dey yarn. Yes oo, the door dey open. “I brought you yam and egg vegetable sauce with fried plantain” Fumnanya dey yarn. Hmmmmm you sabi the matter and you do well for me but I no feel like to eat. “You opt not to take your drugs without meal, don’t worry I would eat with you” Fumnanya dey yarn. Ok bring bottle water from fridge, na so we chop finish, no word come out from our mouth except thank you and your welcome.

Me con dey look her like DSTV wey dey load, whether words go come out as a sharp guy I need to break the silence. …After many beating around the bush, I con tell her say the way I love her be like assignment wey I copy, wey I no fit explain. She just dey blush, wen I put hand for her neck, the next thing wey I dey my mind na to kiss her na eem remain, before I say Jack not even Robinson, our mouth done jam each other. We just dey like dat for one minute, before my hand con dey explore her body. Me con help her pull the gown wey she wear, her body ignite my head like say na two rock jam each other. Na so I put mouth for her br*ast, sU-Ck am one after the other. She con move body go up, as I take pull her p*nt comot, her p*ssy be like fresh palm wine wey I need to tap. I dey sU-Ck her p*ssy join with my finger wey dey brush inside, her body dey vibrate like say na nokia 3310, me no gree stop until her engine knock. Na dat tym my d*ck aka ‘spatarcus kill dem all’ ready to enter arena, as I dey pump her, she just dey scream ‘ovrigado’ say make I no stop. As I wan c-m she just kneel down, collect everytin for mouth. She just cuddle for my body, as we dey yarn tins about life before she con say she need to go house before her uncle go dey find.
The night still be like baby, so I need to chop meat, na so I waka go aboki wey dey we area. As I reach there my phone con dey ring, na Ifetola Gold wey we dey work together for work call me, he tell me say oga won see me first thing in the morning. Aboki give me suya 500 naira and put pepper well oo. ‘Na eem be dis’ Aboki dey yarn. Say you get POS. “Kia me no know dat one” Aboki dey yarn. Do make you dey support cash less policy oo, na ur money be this. As I match enter my compound, after I done greet my goons dem like wrestler wey won enter ring go fight, na so NEPA bring light and I con dey play music Sean Tizzle album ‘The Journey’…

I just notice some kind of noise wey no normal, I be won lock up but my mind no gree settle down. Na so I put ear for window side, I con dey hear men voice as dem dey whisper, see trouble oo, men done con do breaking and entry for we compound and me no get anything to drop. As I dey gather all the money and better things to submit wen my turn reach, na so I hear wen dem burst one door con ask “ni bo ni iyara Big T wa *where Big T room dey*” One of the Men dey yarn. I just know say ee don red for me and I need to do something before something do me. Na so I carry my bed up, collect my cutlass wey dey under there, the cutlass done rust but na the perfect tool for the job. As I rest body near my door, na so one of them use leg burst the door. I no even let am waste time, as the light self dey on, na eem I hold the cutlass like gladiator wey dey arena. I con use the cutlass give am tribal mark from face reach him hand, na so the gun fall enter one conner. I just off light, con give am finishing as I take pick him gun. I just use sense come out of my room, con squat waka go front small, wen I con jam one of those men. For dat same position, na eem I take pop bullet for him body, like say na champaign, for my mind I be like Bruce Willis, na so the man shoot me for chest. Time to die never reach oo because ee get many girls wey I never pansh, runs girl wey I never bleep, motor wey I never drive… I con manage stand up from where I dey, na so three men stand for my front point me gun. ee no even tey wen I remember their faces, say na those armed robbers wey I jam for Mama Gbenga store. “So na you be the Big T, oya take this one” one of the men dey yarn. Na so dem start to dey shoot me like thief wey dem dey kill for firing squad. Chia there is God oooo na so I take die…

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 4

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 6

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)