Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 6

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 6

Na so I take jump comot for bed, my body dey shake like earth worm wey dem pour salt. I no believe say na dream I dey because everything wey happen be like real life. I thank God oo say na dream. As I look time, na so I see 07:43 AM dey knack, see kasala don burst, how I wan take reach work on time today and my Oga wan see me … As I manage reach my work place, I go meet Ifetola Gold wey deliver message give me, say where oga dey. “He’s inside the office, probably waiting for you” Ifetola Gold dey yarn. You do well, as I match reach the door, my heart dey drop sound like Mastercraft beat *one producer like dat*, because this my oga na Mr. Awotunde and na person wey I done see once or twice before and any time wey he show face na something wan happen. ‘Good morning sir’ na so I greet am before he look back. “What took you so long to get to me” Mr. Awotunde dey yarn. ‘Hmmm I be dey…’ *the words no gree comot oo*. “Well take this letter” Mr. Awotunde dey yarn. Thank you sir, as take I collect the letter from him hand. “the letter is to inform you that your service is no longer needed in this organization hence forth” Mr. Awotunde dey yarn. I no even shake, as if I be dey expect am and on top I be Big T, I go survive na time ee go take. Na so I stone everybody for work place the news, the thing affect them like fuel subsidy but them no fit do anything. I con call my yoruba love say I won see her and I dey come her area where she dey work as fashion designer for one plaza like dat, say make we meet for one eatery wey near her.

… I dey for the eatery, dey flex my origin as I dey watch ’30 Days in Atlanta’, my belle won burst with laugh wen AY say ‘their father! no sorry na oyibo land we dey, their dad!, their dad!’. As I sight Seyi *my yoruba love*, my eyes almost turn opolo eyes. The way she package, as if na miss naija dem won crown, my mind settle so tey I no remember my problems again. Na so our body join together. “Ololu fe mi, ki lo shele *my love wetin happen*” Seyi dey yarn. Na just small thing oo, how work na. “Fine dear” Seyi dey yarn. Make you no vex say I dey disturb you oo. “Not at all” Seyi dey yarn. Say you remember yawa wey gas, dat day wey you come my place. “Yes I do, what about it” Seyi dey yarn. I dream am oo, say dem con kill me. “God forbid, such would never occur to you” Seyi dey yarn. That one self dey one conner, dem done even sack me for work *na so she hold my two hands, as water comot from her eyes*. “Am not happy about all this trials your facing, am with you till the end and what are you going to do now” Seyi dey yarn.

I won go see my parent first thing tomorrow. “Ok dear that’s good, I got something for your mom”Seyi dey yarn. …. As I waka go her store, she give 12 yards of wrapper and one bead wey. Wey make noise before I get my self say I done think go.

********my journey waka well, as I take reach my parent side. Everybody just dey hail me Big T! Big T! Big T, dat one small self, wen all the aged people con dey do twitter role call #see_Big_T_of_yesterday_don_grow_oh. I manage reach house my family dey around, we story well. As I take give my mummy the gift wey Seyi send for her, she pray for her. The part wey sweet me pass na wen my mummy make me believe say ‘there is no place like home’, na so she sama me better pounded yam with banga soup followed by jack *the dog wey dey our compound*, them slaughter the dog because of me, I con dey feel like prodigal son wey return.

Night reach me and my guys them, they flex for we area, as time to sleep reach, me just bath and I con talk to my yoruba love phone. Me enter my room, so I fit enjoy better sleep for once, na so I see one letter on top my bed. The letter get one kind blood like logo for body, when I open am I just …

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 5

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 7

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)