Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 7

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 7

The letter get one kind blood like logo for body, when I open am I just see my name for BLOOD LETTER.

“Dear Big Timothy, you crossed the path of the un followed. We got our eyes on you and what we want, we shall get. Which is blood for blood, life for life. Your are a prey to the COLD KNIGHTS and you must go down. You won’t see it coming”.

Na so I look inside the room, con dey wonder how person take put the letter there, I go ask my people for house Whether them see anybody wey drop something for my room, them say no. Sleep no gree catch me because I never know who be this people and me never do any body bad thing before. I know say ee done red for me and I need to comot for my parent place, before those people ‘shoot bird miss him mama fly. Before fowl make noise for morning, I done waka comot from house so that anybody no go know apart from my parent, because I even beg dem make dem no tell anybody say I don comot.

…I dey inside bus, wen driver dey knack better song, but this track na die as my voice loud pass ‘…no be you I carry come but na you I go carry go’ *Kiss Daniel ‘Woju’*. Next thing wey I notice, the driver match brake like who Road Safety stop, I con dey wonder, as I see two motor wey double cross us like say dem dey act ‘Need of Speed’ for niaja road. Two people come down from each of the motor and I recognize say na those men wey come attack us for mama Gbenga store. Na so dem shoot gun for air, as me bend head make dem no shoot me. Na eem dem point gun for my head, as I look up, chia I almost cry as na fine anty *Fumnanya* dash me better slap with her small hand, the sound do wiiiiiiiiiiiii for my ear, as if person blow knockout for inside room. Before I get my self from the slap, one of the men knack me gun for head, hmmm everywhere turn black and white.
+++++++++++++++
I no even remember anything at all, my head be like memory card wey china phone format. As I dey get my self small small, I notice say na chair I dey, dem tie my hand go back, con still blind fold me. I just dey wonder wetin I do all this people, all my body be like load wey heavy, as power don reduce. The big thing wey dey my mind na Fumnanya wey I see, this girl surprise me, she no even act as if she know me, not even love me.

Time pass, na so I hear the door sound as ee open, I dey count how many leg the person put for ground before ee go reach my side. 1,2,3,4…..as I one count five, na so water pour for my body. The person no even loose the cloth wey dey my eyes, as ee con dey interrogate me, see beating. The most important question wey the person dey concerned about na ‘who I be’ and ‘who I dey work for’. Me no even answer any one. Until he vex go.

Ee tey well before Fumnanya con enter the room, this time she waka come like better person with food. She say if I eat finish we get something to discuss. My blind fold and my hand wey dem be tie, con loose so dat I go fit chop the food wey dem bring come. The light wey dey my front, over full I no even see any thing as she take waka comot. I chop the rice wey dem bring, because na only God know when I chop last and make autopsy no go talk say na hungry kill me. After I chop finish I con dey study where I dey, na one room wey no get window, na only one door and two chair with table.

The door open again, this time, two men follow Fumnanya enter inside, I just pretend like say I no get strength again. “The reason you are here mr. Big T, is that you have crossed the code of conduct of the COLD KNIGHTS. Attacking three of our men and compromising a high rated mission and you shall go down for it” Fumnanya dey yarn. I just carry head look am with strong face, she no mind me as she continue to dey talk. “We got eyes everywhere, we know everything. ;”Your yoruba love Seyi” Fumnanya dey yarn. I happy as her plenty talk finish, na eem I done use stlye take one of the utensil tey cut one of my hand wey dem still tie. As she con talk the one wey shock me like high tension, “give him the injection with the tag ’32BFT’, if he survive, then we can commence the next phase” Fumnanya dey yarn. Na so she and the second man con go outside.

I survey the place, as I pretend like say I no know wetin dey happen, na so the man carry the injection dey waka near me, while him gun cross neck. I quick do quadratic equation, wey na matter of life and death, if I attack am ee go shot me like hunter wey catch meat or the others go come interfere. As he take bend my neck, so he fit inject me. Na there he make mistake, I just use the table as weapon, tey push am go back. Na so I catch him hand, twist am tey chook am for neck like the one wey Daniel Bryan do for Batista for ‘Wrestlemania 30’. The man fall for ground, con dey shake as if he catch imbecile. People are bad oo na wetin for do me be dis.

I con waka open the door, as I look around whether camera dey look me, I no see any one because the house be like normal one. I just use sense find way reach the backyard, as I take jump the fence na so I hear POH! POH!, but the bullet no touch me, as I reach ground, I tear race as if I dey do run for Olympics but two men con still dey pursue me. As I look back one done point the gun for my body, na so I jump enter bush. Na God save me Because na one small pit I fall enter. Next thing dem scatter bullet for where I dey, based on say dem no see me, no one touch me. Na so I hear “Ma, we’ve lost him, okay we are on our way” one of the men dey yarn. Na so dem waka go. I trek to the extend my shoe con sabi road, night done dey reach wen I burst enter main road. I stop motor tire, but no one gree stop. Na so I hear “we got him” one of the men dey yarn. As I look them done park car for my front, na so one point me gun and the other dey make call. As one waka near me, with vex wey dey my eyes, I just dey follow am with sense, till I reach near the motor. As dat one wey point gun for my neck dey my back, dey follow me. “Get in the car” one of the men dey yarn. Na so I take do like say I wan enter the motor, wey give am elbow for belle, as he shout con won shoot me, na eem I con do like Rambo take collect him gun. As the tin dey happen the other won no even worry, as he take shoot me but as a sharp guy I just fall go ground na so the bullet touch him second for chest. Me just shoot am for leg, as he dey fall, I shoot am again for head. I just dey happy say I done see motor wey I go drive go house.

For like two hours I dey road dey drive and still dey think how my parol won take be, I just confirm say I dey go my yoruba love place first. Na so I see one of those men wallet for the motor, I check inside, the money reach 7500 naira, na so I take the money, I no even look wetin dey again for inside the wallet. As reach Seyi place, my cloth be like who win Gulder Utimate Search as people wey know me dey Question and Answer section: ki lo se le *wetin happen*. Me no even answer dem, me just run enter inside, when I reach Seyi room, the door dey lock. Na so I ask the compound people, them say dem never see her since morning. Na so I waka go use all those people wey dey make call phone take call her. The number ring two times she no pick.Next one na man voice I hear. “Hello Big T, I told you we got eyes on you and we are every where. Its Mr. Awotunde speaking to you and we got Seyi here with us” Mr. Awotunde.

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 6

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 8

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)