Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 8

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 8

Na so I call my mummy with another phone. “Hello, am in the hospital now” my malle dey talk. Wetin you dey find there by this time or them they share mosquito net for the place. “Not at all, you dad was attacked by strange men, they shot him twice, I pray he survive it” my malle dey talk. Mummy abeg hold body well oh, I dey come meet una very soon. As I make the call finish, me know let her know wetin do me so if fit avoid stories that touch. I just beg the guy say I wan use the first phone he no gree until I forward am 4K.

My waka now na to go see Ufosky my computer geek, because ee get wetin I want make him do for me. As I drive reach him compound, I just look the motor well well, Whether I go see anything wey fit give me better clue, I just no understand because the motor be like wetin them gbab from another person, na so I vex carry the wallet.

I knock Ufousky compound gate, so tey na stone I con dey use. “Kia who I be for there” Gate man dey yarn. Na me Big T. “Me say Big Tree, walai here no be forest” Gate man dey yarn. Suleman you know remember me again, abeg na Ufousky I dey find. “Make I come tomorrow, you go see am for Ufosky” Gate man dey yarn. Oh this aboki won spoil my show oo. Hmmmmmmm na so I say ‘SAI BABA!’. “SAI BUHARI” Gate man dey yarn. As he take open the gate for me, I just happy.
The compound na four flats, as I knock the door, Ufousky open am sharp sharp. As I enter inside the room, kweke! Kweke’, na fat be this, Ufousky you won kill urself, anty good evening oo. As I take greet Ufousky girlfriend wey fat like cow, all of them con dey laugh. Me and Ufousky con enter him workshop, one place wey he dey do him computer things for him house. I upload everything wey dey do me give am. “I don hear, wetin you dey plan to do” Ufousky dey yarn. I just want you update me, the location of the last call wey I make with this phone,this wallet check the identity of the person and every infomate wey you fit get about COLD KNIGHTS.

Na so ee knack the computer me just dey chill with one bottle of origin, na so he give me every informate wey I need to know. The person wey get the wallet information wey he tell me no dey relevant at all, he no get link to COLD KNIGHTS. “Hmmmm this ‘COLD KNIGHTS’ hard me to crack but I done run am oo, them be dirty killers wey dey pia people for their selfish reason and them never even spread at all, na new gang” Ufousky dey yarn. Ok I dey feel you, abeg tell me more. “Mr. Awotunde be their oga and Fumnanya be their Squadrat Queen *second in command*, but them get strong weak point” Ufousky dey yarn. Tell me their weak point *na so I draw my chair near am, he con give me better strategy wey I go use take treat their f--k up.

Me con give am the key of Toyota Civic wey I pack outside, sake of say, I no know Whether I go survive the mission. The things wey done do me, my daddy wey dem shoot and my yoruba love wey dem kidnap, I know say my odd to survive fit be 1.01 like Real Madrid vs Genova. Me ready to die for Seyi, so dat we country go mark my name as naija Romeo.

My next waka na Irumole place, as I fall in enter, he recognize my voice as he open. Me yarn everything wey dey sup with me. “Guy, this no be one man fight oo, you need to report give police” Andrew dey yarn. Abeg no worry yourself, my head strong like cement wey soak water, for this matter. “I get one of my guy wey fit help you with tools” Andrew dey yarn. Na so we enter motor take move go 22 Coolval street, one local setting be the place. The person wey we go meet na Pizzaro and Solace, as I reach there my mouth drop water, see guns wey reach to fight world war. Na so me take everything wey I need join one bullet proof vest. I still con call Ufousky wether any changes dey. “No changes, but I go like make you quick reach there oo” Ufousky dey yarn. You do well as I take cut call. Na so Pizzaro con say he get better power bike for me and say anything wey happen he dey my back.
**********
I just dey cruze the power bike with better speed, as if na those android bike games I dey play, if you be dey motor and I drive pass you, hmmm! Na only sound you go hear. I con drive enter one lonely part, I con sight the location wey Ufousky tell me, na so I take pack the bike for bush, con trek waka reach there. My mind dey beat but I no dey fear at all, as I reach the gate, I waka go the side of the compound, con jump the fence. As I land ………*drum roles* ghen ghen ghen ghen ghen ghen eh shin shin shin carry pomo….

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 7

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 9

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)