Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

” Why?. Wetin she tok?” I ask bekky.


She no respond, she jus de smile de go. I ask am
again, dis tym she begin laff. Serios laff, she de laff
sotey she jus kari bodi nack 4 ground as ha laffing
de increse de go. Me and biggy look oursef, look
bekky. She stop de laff, look me 4 face, look
biggy….. continue ha loud vexing laff.
Wen she finally get hasef, stand up naim she luk
me….
” Oh, u look pesin lyk anita de yarn love mata to am.
Hahahaaha… Anita wey no gree date any guy
thruout wen we dey skool naim u just see am 4
camp now de tok say u love am pass ur life”. She
continue ha laff.
“Mtcheeew! So na why u de laff lyk mad
woman…see, bekky, e no mata weda ur friend date
abi she no date anybodi 4 skool, if my guy tok de
right tin and push de koret button she go jus folo
am lyk mumu de go, so node tok wetin u no no”
biggy reply am.
I jus de boil inside lyk hot water. Dis babe 4 don jus
close mouth. She jus de run ha mouth lyk small girl.


I hope say she go still run mouth give bekky wen I
finally fucckk am.

” Well, anita my friend node use ear hear anytin
love. She hate am. But wait o, how u go see babe de
yarn am say u love am jus lyk dat. U think say she
be small girl abi wetin. Haa!! Nobe lyk dat o. Evritin
get process”.

I luk dis babe as she de lecture me about love.


I blame mysef sha. Na me cos am.

We reach one bush wey dey 4 bak of male hostel,
dem say mak I hang around de observe 4 dem. As I
still de wonda wetin de hapun naim 3 oda coppas
wey dia eyes red lyk say dem pour blood inside
waka de comot 4rm de bush, dem shake hands wit
biggy and bekky, luk me, one of dem….

“Oboy why u com standa hia lyk spy nah, if u wan
smoke weed enta inside wella”. Biggy tell dem say
na all of us folo.


Some guys still de enta de bush, some de comot.


I com de wonda how dem take get de weed 4 camp
dia. Abi dem kari am come camp.
For close to 1hr, biggy and bekky neva still comot
I luk my time 8:02pm, I enta de bush drag biggy 4
hand comot, warn am say if weed mad am I go jus
deny am sharp sharp.
” Make we de go de place b4 dis soldiers stat de
chase us inside na”
bekky de tell am.
I ask biggy wia dem wan go, he jus smile Say make
I folo am 4 bak. I tell am say I node folo am go
anywia unless he tok wia we de go.
” E go even beta mak u no folo us sef ” biggy reply.
Hmmm. Since me and biggy know he neva tok lyk
dis b4. Biggy wey de like mak me and am folo de go
evriwia 2geda. Biggy wey no fit leave me comot go
anywia, de tell me now say e go beta mak I no folo
dem. I laff 4 my mind, decide say I must no biggy
plan.
We waka pass camp kitchen, copas still de chop,
sum de yab dia sef, sum de shout, sum de laff.
sum
dey for group, sum dey alone. sum de enjoy diasef 4
camp, de wish say dem go extend de 3 weeks to
3months. Sum still de wonda why days de go very
slow, dem don stay 2 weeks 4 camp but e be dem
lyk say na 3 years. Evribodi jus de mind dia bizness.
Evribodi jus get clear mind say evri coppa wey com
de camp get de same goal and objective. We de see
oursef lyk say all man na still virgin…….

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6