Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

“Hey! Biggy I don Bleep up!. Evritin wey me and dis
babe yarn I 4get kolet ha numba.” I tell biggy as we
de comot 4 de bar. I beg am mak Im call bekky kolet
anita numba. he call bekky, she send de numba, I
call am,
“De numba u’re callin does not exist”.
I call am again, de same tori. Biggy call bekky
complain to am. Bekky send de numba again. I call
am, dis tym dem tok say d numba no avalable. I get
hope say atleast b4 nite de numba go conet. I call
am 4 nite, e neva stil avalable. I try de numba
saturday morning, de tin ring.
I call anita numba thru out saturday but she no pick
am. De numba de ring bt nobodi pick.
Sunday morning. i de wash my shoe naim james
(my friend wey be pastor) com again de insist say I
must folo am go church. I tell am say I wan wash
my cloths and na only 2day I go get chance do am.
James no hear dat one. He tok say I must folo am go
church, if I com bak I go wash. Hmm. I say ok say.
mak im de go church mak I go baff meet am 4
church, de guy no gree, he kari my bucket, go fetch
water say mak I go baff. Im go wait me. 15mins leta
de guy kari water com. I no no wetin I go do, I jus
de look am. I use de water baff, wear my wite long
sleeve, tuck am inside my trouser, we stat de go
church (inside camp)
We enta church, james say mak we go sidon 4 front
bt I no gree 4 dat one. He jus leave me dia go front
sidon and by den we don reach middle, i luk left and
rite no space, I turn bak de comot outside naim one
boy touch me say pesin de call me 4 front. I turn
bak see one babe de wave me. I luk well see say na
de babe wey I don de find since. Anita.
I go wia she dey, she shift 4 me naim i sidon, face
front de listen to wetin dem de tok…
” Wia u dey since?” Anita ask me. I luk am, she de
smile one kain wayo smile.
” So u no wetin u do abi” I reply am
” Wetin I do?” She ask me. I no reply am, I jus face
front, de form vex. She touch me again..


” Wetin u say I do?. I don de find u since dat day but
I neva see u o” she de tok wit laff.
” So u no see my call abi. Why u no wan pick my
call?”
” I no see ur call o.” She lie
” Anita u still dey 4 church de lie. U de lie inside
chuch”. She com smile, tell me mak i no vex say she
no pick my call, say ha vex be say bekky no tell am
b4 she send ha numba giv me. I ask am weda she
don save am, she say she neva save am but mak she
save am now. as she de comot fone naim pastor…
” Abeg mak una kari am 4 mind say dis place na
chuch. Nobe wia dem de do boyfriend and girlfrind.
If anybodi wan tok mak Im comot outside”
Omo i freeze o. I no say na becos of me and anita
naim he de hala.
As we dey go ha hostel (wen chuch dismiss) i tell
am as i don de tink about am since wen I see am, as
I don tak love am pass my life, as i go wan mak we
date even wen camp finish. She jus de laff. We
reach ha hostel, she tell me say mak I de go, say she
go call me 4 evening tym make we tok wella. I tell
am mak she no call me, I go call am and if she no
pick my call, me and am go get problem.
“Yes sir” she reply me, shake nyash enta inside ha
hostel.
6:30pm, me, biggy and bekky de stroll, I call anita,
she no pick call. I wait 10 more mins call am again
omo de babe busy my call. I call am again e com be
say she don swtich ha fone off.


“Biggy dis baby don off fone 4 my ear o”
I ask bekky wia ha friend dey and wetin mak am cut
call 4 me. She use ha numba call anita 2nd line, she
pick. Afta dem don tok finish, biggy hand dey bekky
waist, she stop, luk me 4 face….
” Make I no lie 2 u. I no sure say my friend like you
o. I go advice mak u find anoda babe “……

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6