Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

” Abeg no shoot, no shoot oo… I be coppa abeg o”
I raise my hands as I de try explain mysef 2 dis man
wey wan blow my head scatta.
” WHo u be !!!?, wetin u de do dia !!!?, if u mak any
move I swear I go sHoot you!!! “. De man de flash
me torch diret 4 face, de hala. As I de try ansa one
quesion de man go thro anoda one, I jus de shout
de beg am say I be coppa…
“Liar!! Criminal… U be coppa.. So hia na ur hostel
abi…. Oya jump down 4rm dat fence now. If u eva
try run I go jus shoot u.”



As I de jump down naim de man de blow Im whistle
mak he alert odas. he say mak I lie down 4 grass
dia, na dat tym I see de man face….


RAMBO
Rambo na de army man wey de giv us terror 4 dat
camp. Naim de announce evri mornin 4 parade
ground, de remind us rules and regulation of camp
and de kain tins wey Im go do anybodi wey brek
dem. De man node laff, he node folo coppas play as
oda army men de do. De man huge com black like
devul wit deep marks 4 face. For my mind I don no
4 sure say my days 4 camp don end, I nogo spend
one more day 4 dat camp as far as say na dis
wicked rambo stand 4my front dia. See camp wey
remain only sum days mak I comot naim biggy and
Im ganja babe jus destroy. De worst part be say
biggy sef wey put me 4dis wahala jus close mouth
wit im babe, mak I use my head kari de problem
mysef…..
“…If u look me again I go use my boot scatta dis
teeth wey full ur mouth…tiff. Who u be and wetin u
de do hia !!? ”
Rambo ask as he de blow im whistle de search me
4rm head to toe, even my prick.
I tell am say I com droppings 4 de bush but de man
no believ me. He no beliv say I go enta inside dis
kain thick bush by dis time jus becos I wan
droppings. He comot my I.d card, observ am…
“Oya wey dat igbo?, wia u hide am? “. De man ask
me. I tell am say nobe igbo I com smoke, I neva
smoke igbo 4my life, ok com smell my mouth no
weda I de smoke igbo . He say mak i bring my two
hands 2geda 4 back, he comot rope de tie my
hands..
” Rambo Rambisco RATaTA !! I no no say na u
sef….. Na bigiano de yarn ”
Biggy de smile as im de jump down 4rm fence..
” Who be dat… Stand dia, no jus move”
The man command wit enuff soldierman anger for
Im voice..



” Ahh oga rambo, na me biggy nah…. Na my guy be
dat o…. Notin de hapun….we jus say mak we do
small adventure dis nite sha hahahhaha….”
” U de craze !!!.. U and who de laff…I say stand
dia !!! No jus move one step..try me and see ”
Rambo de hala biggy.
“Rambo na me o” biggy voice don de change to beg
now. He don see say tins don serios. I still lie down
4 ground. Biggy de wonda wetin im go do. Rambo
still hol my hands 4 bak de contemplate as he go
use tie 2 of us 2geda kari us go bak camp. He Pour
flash biggy torch again…

” Ohh…una de furck abi…hehehe… U too stup!d
sotey u even 4get zip ur short…”. Biggy use speed
kari hand cova Im zip wey open. He de try explain
giv rambo say we node Bleep any babe, naim de
man….
” Who tok say una de furck babe…??.. I see una wit
my korokoro eyes as 2 of una de furck unasef, notin
relate babe mata hia….inshort na 2moro mornin una
go no why dem de call me rambo ”
He comot de rope wey he tie me, say mak two of us
de match go front, tell us say if we like mak we
run….biggy nogo hard to find 4 parade ground in de
mornin. Wetin jus dey my mind dat moment na 2
run comot, 4get evritin about camp. Afterall weda I
run abi I no run, dem go still decamp us as far as
say na rambo catch us.
We de beg am, say we go giv am money, na dat one
even mak am vex more. We don waka small naim
biggy stop, turn back wia rambo dey, rambo de hala
am mak he de move, biggy de calm am down.




Biggy
say mak I de go front. I luk back see as biggy de
reason wit rambo. I com get hope small..
Afta like 3mins, 2 of dem turn de go back… Back
wia bekky dey!!
I de folo dem small small. We reach de place, biggy
climb ova de fence, rambo folo am climb ova……
……Bekky no dey dia again..
….Only mattress naim dey dia, next tin I hear na
one kain loud slap… ‘” TUWAiiii “‘
” So u de use me play abi….u tink say na play I com
play hia ?? ” Rambo giv am anoda hot slap naim I
hear biggy cry de tok..
” I swear na hia she dey b4… E go be say she don
run comot I swear…ok ask my friend abeg oo..”
” I go show una pepper dis nite b4 dem comot una
2moro… Una de furck unasef abi..haha…. Una no
see all dese fine fine babes wey full evriwia 4 camp
furck … 2 of Una go furck tire dis nite..Oya climb
ova b4 i whooze u anoda slap..” Rambo de hala.
Biggy climb ova d fence, we wait sum seconds,
rambo neva still comot. We wait more, we no still
see am naim we go peep mak we no wetin de hol
am. We see am as he hold bekky bra 4 hand, de
flash torch around bush like say he de find more
evidence…. He search around de mattress, flash
torch evriwia even ontop tree, com off de torch,
Darkness evriwia….2mins leta naim he put on de
torch….
bekky dey Im hand de cry, de beg…..

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6