Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

” Hehehhehehe……… I tell u say u must enta my
trap b4 u comot dis camp…..bekky….hmm…by de
time I don finish wit u, anytime u see army man u
go tia race. Shey u and ur friend anita de shake una
dirty nyash anytime wey una de pass wia I dey…. U
go shake dat nyash taya 2moro 4 parade ground “.
Rambo jus de rake de go.




Bekky wey bin de form hard babe sum hours ago
don transform now de cry like small pikin of 4yrs,
de beg rambo, she fall 4 ground hol im leg, rambo
jus kick am like ball comot Im bodi, she roll enta
bush, he rush am again drag am 4 hand lift am up,
she de cry de beg am, de tell am as her papa take
die many years ago and how her poor mama take
suffer train am 4 skool and na she be 1st pikin 4 dia
family, If dem decamp am naim be say ha own don
finish.



Naim rambo …..
” Oh.. So u no say ur mama poor naim u still com
camp de shake nyash 4 me abi, de furck anyhow….u
Pour camp 2do ashawo…oya giv me ur I.d card now.


Ashawo like u..I go mak sure say I…..”.


Bekky cut am short…
“…ok oga rambo abeg I go do anytin wey u
tok..anyhow u want am.. Anytime u want am….I go
pay anytin… Abeg anytin u tok i promise say i go do
abeg I no wan comot 4rm camp…. Na dis boys wey
dey hia force giv me igbo mak I smoke and i neva
get mysef since den…”
” Shut-up!!!!!.. Dan banza..ka ci gusu uwarka… U
de craze!!..I de tok de one wey u do naim u still de
implicate ursef…u wan bribe me abi…u too
stvpid…u go do anytin I tok…see ur ashawo
mouth…u wan use toto bribe me….go bribe ur papa
wit ur nonsense toto…..oya climb ova dis fence b4 i
do wetin evribodi here go regret..”
Bekky jus kari speed climp ova de fence wia we
dey. 3 of us jus standa dia like pple wey dem wan
sentence 2 death… All man dey silent, all of us de
wait mak rambo climb ova, kari us go slaughta
house. I luk biggy face, omo wetin I see jus mak my
bodi shake, de vibrate wit fear….
Biggy wey be numba 1 hardman 4 camp, biggy wey
notin de eva touch, biggy wey de boast say Im
money go deliva am 4 any kain problem wey he face
4 , …..tears de flow comot biggy eyes, he see say I
de luk am naim he jus bend down face, luk me
again….lyk say he wan use eye tell me sorry 4 de
kain wahala wey he put me, he luk up, face de moon
wey don increase 4 briteness. De more he de wipe
tears de more de tin de flow comot. Bekky still de
cry .


Rambo finally jump com ova wia we dey, kolet our
fone and I.d card, rite our name and reg numba 4
paper, search us again. Afta evritin he luk us, say..



“” I go use una teach oda pple lesson 2moro mornin.
Una go learn as to obey simple instruction afta I
don punish una finish…. Oya mak una hol hands 4
single file de match enta camp NOW !!!! “”

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6