Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

We obey am, hold our hands like prisoners de go
camp ground. As we still de waka naim biggy turn
bak again mak im tell rambo sumtin naim de man
use force kari big stick wey Im hol 4 hand nack
biggy 4 back omo nobe pesin tell de guy mak im use
run join de line, na den all of us realise say our own
don finish. We don de comot de bush, de near
kitchen side (wia we from comot). from wia we de
naim we de hear oda soldiers as dem de gist, I still
de wait mak rambo tell us mak we stop. I still de
wait mak Im kari bekky enta inside bush go furck
dis free toto wey she offer am. I still de wait mak he
call biggy so dem go negotiate as we go tak buy our
freedom. I jus wan mak miracle hapun…
“‘ Make una stop !!! “” Rambo oda us.
” Wey dat girl, oya come hia “. He call bekky. Bekky
stat de go back wia he dey. I jus hapi small 4 my
mind. I luk biggy, he luk me smile. which kain man
go see dis kain free, fresh coppa toto he nogo furck,
so rambo jus de pretend since like say im na saint
.
As bekky reach wia rambo dey, he jus de luk am
4rm head 2 toe, hol am 4 shoulder, stroke am
small…
“” Shey u say u go giv me anytin I ask ? ” He ask am
“‘ Rambo dear, anytin u tok I go do “. Bekky reply
am as she de smile one kain s£duce smile.
” U sure? ” He ask am
Bekky nod head. Rambo luk us, oda us mak we face
face front, kari bekky de enta inside bush..
” Hahaha…guy we don free be dat o” i tell biggy as
2 of us shake hand
” I tell u mak u calm down, notin go hapun. I no say
we go survive dis tin…ah !!. Dis one na small
challenge nah, I don swim pass oceans wey ruff
pass dis one…hahha “. Biggy jus de boast
” Haa.. See as de man use im hand implicate imsef.
” I reply
4mins leta naim we hia rambo angry voice…
” U be fooool!!!!….see ideott wey I wan help…..




Oya
comon enta line…I go show u pepper 2day…infact I
go show all of una pepper….”
” Sir I no fit do dat kain tin….e beta mak u kill me….e
beta mak I die….” Bekky de reply am
“” Shut up!!! If u tok one word again I go use my
belt stangle u now and nobodi go do anytin…by de
time I finish wit u, ur mama nogo fit recognise u
again….I go show una say me na army man…”




Rambo de rake. Me and biggy jus dey confuse, we
look oursef. Rambo de push bekky 4 back, de kick
am, she fall 4 ground naim rambo raise im boot mak
he match am 4 ground dia, I rush drag bekky comot
dia. De man look me….
” Ok u be hardman abi…u go show me how hard u
be wen we reach guardroom.” He command us.



As we de go naim bekky tell us wetin rambo tell am.



He tell am say if she go gree tell panel 2moro
mornin say na we and anita dey 4 bush but she
(anita) leave us run comot as she site am(rambo),
say if she go tok am, he go use im power mak sure
say dem no decamp am (bekky). Na den I no say dat
man rambo na devul.




we comot 4rm bush de waka enta wia oda army
men dey omo I see say dis guys reach four o, as
rambo see say we don de reach wia im men dey
naim he grip me and biggy 4 neck, push us de go,
de curse us. We finally reach wia dem dey, he say
mak 3 of us lie down 4 ground. dem de ask wetin we
do, naim rambo stat de yarn dem….

“” I see dis ideots inside bush o. by Dis time.

Oda
copas don enta dia hostel de sleep naim dis ashawo
and dis boys go……”
“” Commandant say mak evribodi report go position
outside gate NOW NOW !!!! ”


De soldier wey be 2nd-in-comand to camp
commandant comot from no wia, oda all of dem.




All
de army men wey dey dia standa wit speed, kari dia
torch and oda tins de run go gate……but rambo still
dey dia wit us.


“” Aminu !!!! U no hear wetin I tok?, wetin u still de
do hia?”””
de comandant ask rambo wit vex naim he reply am..



“” Oga dis copas hia…..I catch dem inside bush….””.



De comandant cut am short
“”” Aminu u de try disobey my odas ??, Serious
shoot-out de go on now 4 d next community and
comandant don oda mak evri soldier go position
outside gate now naim u still dey hia de find who u
go catch inside bush….if i reach base now and I no
see u eh, infact u no me !!!. “”



De comandant stat de comot naim I rush tell am say
rambo kari our fone and I.d card, he oda am mak he
return am bak 2 us, say mak we run enta hostel b4
he change our matta.




4rm dat day on no soldier rememba de case
again…..
……Even rambo.

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6