Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

I no beliv wetin I hear o. Ochuko ayeni ?. D one wey
I sabi abi na anoda 1? How ochuko name take enta
commandant book? I neva see ochuko for many
days and I don even 4get say she de exist.
De comandant call ha name again, threaten am say
if she no comot , ha own don finish b dat na dat time
she slowly comot 4rm wia she dey, de go middle of
field. She reach wia comandant dey. He de look
ochuko, ochuko put ha face down. I jus de look dis
babe wey bin de yab me and my papa sum days
ago, Dis babe wey i bin furck ha toto scatta sum
weeks ago, dis babe wey be SUG strong babe sum
months ago. Ochuko. She jus standa dia. Shame no
gree am luk up. De comandant kari mic, stat again…
“‘See as she de look innocent. Pesin wey see am
nogo beliv say she don sabi wetin be furck…. Dis
girl here na disgrace to coppas…… De boy wey bin
de furck you com see me run, wia he dey ?”‘.




De
commandant ask am.



Ochuko jus de cry, she no fit tok anytin naim de
man announce say make de guy wey bin de furck
ochuko comot now. As usual, nobodi gree comot.



He
tok am again, nobodi comot. De comandant ask
ochuko de boy name, she reply say de guy tell am
say im name na ‘buLL’ and na wetin she de call am.
He ask am de platoon wey de guy dey, she no know.
De commandant now tell am mak she and 2 army
man check evri coppa wey dey dia. Dem stat de
chek evribodi face, one by one. De army men mak
sure say nobodi de hide im face.
……Ochuko de near wia I dey……




E remain like 15 pple b4 she reach my turn. My
heart de race…hehe…2day na 2day…dis babe fit
decide to wicked me now. She fit point me.




Anybodi
wey she point now de go down wit am. Who no
wetin dey ha mind…ochuko…. but I no do am any
bad tin. de only mistake I do na becos say I know
am, de last tym we meet na she embarass me sef.





As she de com near me I jus de rememba de 1st
tym I call dis babe 4 fone. I de regret why i mak dat
call. I 4 don jus dey on my own…..she don de com
near me, e remain jst four people mak she reach
wia I dey. My heart de beat very fast, my leg de
shake, I jus de breath very fast. She finally pass de
babe wey dey my side, com wia i dey……
………….Ochuko com wia I dey, standa de luk me.



I de luk am she de luk me.



E com be lyk say my breath don cease. To breath
com de hard me….
..”‘ Na de boy be dis ?? ” De soldier ask am.



She still de luk me, she no tok. 4my mind I jus wan
push de mumu babe comot my front, push am well
well. Wetin I do dis babe?, why she de look me ?,
why she wan wicked me now ?. De soldier ask am
again
“‘ Ashawo u node hear again abi !! Na ur partner in
crime be dis ??, dis na de last tym I go ask u !! ”

Ochuko finally ansa…
“‘ Yes na de boy b dis “‘
Omo shout 4rm no wia enta my mouth. I de tell dem
say de babe de lie bt she don tok be say she don
tok. I nofit do anytin about am. Dem drag me enta
middle of de field wia de comandant dey, say mak I
kneel down dia. I still de xplain to am say nobe me
and ochuko bin de furck.


He observ me 4 som tym, say mak I comot my shoe,
I obey am. He bring out anoda shoe wey dey im
bag, compare 2 of dem, my own big wella pass dat
one. He ask me again, I tell am say me and ochuko
no get anytin. Yes, na me and am folo com camp but
na dia e end. De comandant say mak I go bak. He
com look ochuko, tell am say de shoe wey he hol 4
hand na her furckmate shoe wey he pick 4rm de
place wey dem furck. ( De guy forget im shoe as he
wan run,). He warn ochuko say he de giv am last
chance mak she go round again, comot de pesin
wey bin de furck am…..

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6