Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

20-30 mins leta naim dem drag ‘Bull’ (d guy wey bin
de furck ochuko) comot 4rm wia im hide 4 crowd.
Camp commandant com oda mak dem lie down 4
middle of field dia, com tell d oda two boys wey dem
catch inside hostel say mak dem kari d water wey
dey inside dia bucket pour ochuko and im guy 4
bodi dia, say mak d boys go bak line ( dia bodi jst de
shake like pple wey get epilepsy as dem de waka).
He com stat im long speech again about how he go
take punish and decamp ochuko and bull, how he
go mak sure say nobodi try dat kain rubbish 4 im
camp again, how all of us na bloody civilians. He
com de yab us 4 hausa……
……De yarn us de kain suffer wey he pass thru b4
he becom army man, com tok say all of us wey dey
dia, and our papa, no fit survive wetin im see b4 he
becom army man naim one voice 4 back com
shout….
“NA Lie !!!! ”
Commandant close mouth. Evriwia com silent. He
turn diretion wey d voice 4rm, waka go dia, ask dem
who tok dat tin, nobodi gree tok, ask dem again,
nobodi tok naim he oda mak all of dem wey dey dat
area do 100 press-up. He com bak middle of field
continue im speech, still de yab us. ( We com de
wonda why he leav pple wey im catch de furck com
face us ). Afta sumtime he com call…



” AMINU !!!! ”
Rambo run come wia he dey. De commandant oda
ochuko dem mak dem lie face down, tell rambo mak
im go bring 3 thick, ‘wicked’ koBoko wey strong
wella. Rambo run enta dia quaters, comot wit de
koboko. Omo d kain cane wey dis man kari resemble
exactly wetin fulani pple de use flog cow. De stick
big, com fat and long, dis koboko too wicked sotey
para com hol me wey dey dia sef.
Comandant stat
” As I de tok b4, I go use dis pple wey dey here
teach una as dem de tak obey instruction. I no say
una gode tink say I wan wicked dem, I no wan
wicked dem, na help I wan giv dem. I wan koret
dem so dem nogo mak dis kain mistake again 4 dia
life. If I no koret dem now, dem fit mak mistake wey
go bad pass dis one 2moro and e fit take dia lyf…!!!.

He kari 2 koboko 4 one hand, observ dem, twist
dem. Evribodi jus quiet. He Continue…


” Na becos of dis kain offence naim we keep dis
koboko 4 dis camp. Mak I tell una one tori.. Last
year, sumtin lyk dis hapun, na still 4 middle of field
here naim we dey lash dem beta koboko, one of dem
faint, we pour am water still continue de lash am. so
mak una no tink say na jus becos of una friend naim
we keep dis koboko hia. kari am 4 mind say nobe
ochuko and bull wey we de flog, wetin we wan flog
comot na dat bad spirit wey send dem do wetin dem
do. ”


He continue….


” So……..ochuko go kolet 150 strokes…….Bull go
kolet 220….”



As ochuko hear dis omo she jump up, see beta cry,
she hol comandant 4 leg de beg, de cry. Comandant
com call rambo and one oda army guy say mak dem
hol ochuko 4 hand and leg, dem hol am, ochuko de
struggle mak she free hersef bt e com be lyk say
dem use padlock and chain lock im hand and leg.




Comandant come de look am. As she de struggle 4
ha life. He start again
” Becos say u be girl and my last pikin zainab na ur
mate, I go jus pity u. ”




Our tension com reduce small….I no say comandant
nogo use dis big koboko 4 dis babe bodi….haaa, he
nogo even flog am reach 5 stroke she go jus die
nobe even 2 faint. See ochuko wey faint jus lyk dat
(nobodi touch am o) wen we get dat experience as
we de com abuja naim pesin….nobe say na odinary
pesin….military man, wan flog am 150 stroke of
KOboko .



De man continue…



” Yes I go pity u becos u be my pikin age mate. I
nogo flog u……I nogo use double koboko flog u
again…..I go use only 1…oya Aminu mak una stretch
am well..”



He drop one cane 4 ground, ochuko still de
struggle, de shout, de cry…,even if dis man na devul
he no fit lash dis babe 150 stroke of cane, 30 even
much sef.
Our camp commandant raise hand wit force make
ochuko receive her 1st stroke omo naim evri coppa
wey dey 4 field dia shout…
” HEEEEEEEYYYYY ”
Comandant no know wen cane fall comot 4rm im
hand. De man jus enta beta laff mode. He de laff
oda officials de laff, de soldier wey hol ochuko 4
hand leav am de laff….evribodi de laff……but
Rambo. Rambo still hol ochuko 4 ha two legs like
pesin wey de push wheelbarrow, ha hands still dey
4 ground. Rambo no hapi. Rambo no hapi as dem
take leave dis babe. He wan mak dem flog am 150
strokes so dat odas go learn 4rm dia….but rambo
nobe commandant. If say im be comandant he 4 don
lash dem as many as he like….
… But he nobe commandant.



Comandant finally tell rambo mak im leav am.
ochuko and im furckmate get luck becos he de
observe ‘Eid- al-Adha’ (muslim Festival of Sacrifice),
but he must still punish dem….dem gode sweep evri
room wey dey officials’ quaters (about 6 rooms) and
fetch water 4 dem evriday till dem comot camp..

Na 4 field dat day naim I see ochuko face 4 de last
time till we comot camp…



De next day… Wenesday 10.am, me and biggy dey
mami maket de chop. My fone ring.. Babe voice..she
de laff..
” Hahahaha… Hmmm…I tink say u be strong
man….see as u jus de cry ystaday 4 parade
ground….u get luck say rambo no disgrace
u …ahhaahha…”
” Who be dis ?” I ask am
” Oh so u don delete my numba abi..mtcheew “. De
babe cut call.



I no jus dey 4 dat kain mood now. I continue de
chop my food, de gist wit biggy.




15 mins leta, de babe call back again……

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6