Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

Saturday nite, 8:45pm, evribodi dey inside multi-
purpose hall 4 our variety nite. Evri platoon de
showcase wetin dem get. Competition 4 drama, mr
macho, mr and mrs camp, dance competition. Many
tins jus de hapun dat nite. Evribodi de jolly, de hapi
say e remain only two days mak we comot camp.
Sum pple wey fat wella b4 dem com camp don thin
like say dem get one kain sickness, de stress too
much. Evribodi skin colour jus black like pple wey
de live 4 hot desert. Evribodi don tire. De kain drills
wey we don receive 4rm dis army men fit mak pesin
wey no strong kpai. E get day wey we vex camp
commandant naim he oda mak evri copa run enta
hostel, kari dia mattress and bucket 4 head, wear
khaki trouser den wear our wite short ontop de
trouser, comot 4 field unda hot sun. He giv us only
10mins mak we do all dis tins. As we reach field
naim he say mak we lie down 4 our mattress, face
sun. We dey dia 4 more dan 30mins.
As de variety nite still de go on naim I yarn biggy
mak we comot outside 4 air (heat inside de hall don
much). As we comot outside naim we see sum
coppas 4 side of de hall (abt 15) de dance outside,
we jus sidon 4 corner de watch as dem de jolly, de
rock diasef.



Biggy comot benson stick wey dey Im pocket, lite
am, as he de puff smoke naim im yarn
‘” O’boy e no easy o. we don see tins 4 dis camp o.
Infact I no beliv say I go still dey dis camp reach
now. Shey U rememba dose boys wey dem catch
me and dem inside bush as we de smoke igbo ,? “‘
‘” Dem don catch u many times. wich boys u de tok
and wen ‘” I ask am
‘” Hahahahaaha… U don 4get Dose boys wey me
and dem folo com ur hostel dat day wey u bin de
sick… ‘”
”” Ooookkkkkk !!!!…. Dose 2 boys wey skool 4
ghana, one kari dread locks..”‘
I reply am
‘” Yes na dem. Dem don decamp dem o ‘”
biggy yarn as he puff out anoda smoke..
“‘ Heeey !!! So dem don comot dose guys 4rm
camp… Wetin hapun “‘
‘” Na still dat same matta, I tink say dose soldiers
wey catch us 4 bush leta 4get evritin o, I no even no
say dem stil 4ward de mata “‘
‘” Biggy bt na 3 of una dem catch nah, how com
dem decamp only dose guys leave u ..? ‘”
“‘ So ur prayer na mak dem decamp me abi…nawa 4
u o. Well, dt one na tori 4 anoda day sha, mak u no
go pour sand 4 my gari ‘”
Biggy reply as he inhale im cigarette smoke. We laff
ova de matta but 4 my mind i still de wonda hw dis
guy take escape all dis wahala wey de com im way.




We still de look de pple wey de dance, I tell biggy
say I de com mak I go rock sum babes small, he no
tok, he jus comot anoda stick of cigarette, de
observ am, I leav am comot ( de guy no sabi dance
bt im de party and club wella).
”’ Baby escoose me dance ‘”


I tell one slim short babe wey de wine waist like
pesin wey no get bone, de babe tell me say she don
taya 2 dance, leav me run enta hall. I still code
mysef de dance alone, use style de luk around mak I
no weda anybodi notice as de babe embarass me.





I site anoda babe wey jus sidon 4 corner wit ha
friend, de cheer and clap 4 pple wey de dance, I
waka go wia she dey, hol am 4 hand mak we dance,
she standa, na dat time I see ha face wella.



Pesin wey I de find since…
Mary.
‘” Woow !! Mary !!! Na u be dis !! I don de find u
evriwia since. hw far nah. Wia u dey since ? ‘”
De babe jus de smile, tell me say she sef don de find
me since. We stat de dance, omo dis babe na
okoso..she de dance scatta, jus de wine ha bodi like
stripper, instead of me 2 rock dis babe na she de
rock me….she rock me sotey I no no wen i move bak
go lean 4 one tree wey dey our bak, na dia she take
finish me. Mary increase ha tempo, de friction wey
dey betwin us don tight wella, she de grind ha
nyash 4 my prick wit force like say ha mission na to
crush my prick inside my short. I jus hol am 4 waist
de try meet up wit ha rhythm bt de babe too fast
and ruff, she com face me, use one hand hol me 4
neck, use de oda one hol my waist, nw stat de grind
ha whole bodi 4 my own wit force and pressure like
pesin wey demon possess.




As de music still de play I jus hol am 4 waist, dis
babe jus de sweat as she still de grind ha bodi 4 my
own wit force, de sq££ze ha brest 4 my chest, de
heat 4rm ha bodi jus de rise my prick..ha hand wey
dey my waist com travel back 4 my nyash. She jus
de grab am, de sq££ze am wit all ha strenght.




De oda hand com comot 4rm my shoulder, enta my
head. She jus de rub my head, de romance am 4rm
front to back..by den my prick don standa wella bt
de pressure wey ha bodi de apply 4 my own no gree
de tin standa, she jst surpress my prick wit ha hot
bodi.




De radio wey bin de supply our music finally off ( e
be like say battery die ). As mary shift comot 4rm
my bodi omo my prick jus spring up inside my short
o, de luck wey I get b say de place dark small so she
no too notice wetin hapun. She say she don de enta
hall bt I beg am mak she wait mak me and am folo.
She wait sum seconds
‘” Wetin u still de do dia nah !! I go leav u comot o,
infact I don comot .”‘
I beg am mak she jus wait me small mak i piss. I
face de tree, comot my erect prick like say I wan
piss, 2mins leta my prick still standa, e neva still
fall, I jus de sweat, I neva even kolet dis babe fone
numba wey I suppose kolet since, dis na sumtin
wey I 4 don kolet even b4 we stat dance, I jus de
regret. I de try tink about oda tins wey go mak my
prick fall but no mata wetin I tink, I go still
rememba as mary tak de wine ha soft nyash 4 my
prick, as she de rock me.
Biggy finally call say mak we enta inside hall, na dat
time my prick jus fall. I turn my bak bt I no see
mary again.
I use run comot wia I dey, de find am evriwia. I
finally site am as she de enta hall wit ha friend, I
shout ha name naim she stop, turn. I wave am, she
say mak I com wia she dey. As I reach dia naim I
ask am y she no tell me say she de comot, she jus
laff, tell me …
‘” So jst becos I rock u small naim ur bodi de shake
like dis?… If I giv u de main tin naim be say u go jus
die “‘
I jus open my mouth de luk am, I no no wetin I go
tok. I jus de luk mary. I no beliv say na ha mouth
wey dose words comot. I finally comport mysef,
reply am
‘” Well, mak dat tym come 1st ‘”
I tell am mak we comot outside bt she no gree, say
ha friend de compete 4 miss camp, mak she go
cheer am. She com say mak she giv me ha numba
so dat I go call am leta know wia she dey. I comot
my fone again mak I kolet ha numba….




‘” I wan mak we tok now !! ‘”
Anita 4rm no wia again appear 4 my
front…command mak we tok
I tell am mak she giv me sum seconds mak I finish
wit mary bt mary say mak I no worry, b4 i no wetin
de hapun mary don waka enta inside hall.
Na de last tym I see mary 4 dat camp …

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6