Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

Kaii..see environment like desert..how pesin go
live dis kain place 4 one whole year “‘
one coppa de complain 2 nobodi in paticula as we
de com down 4rm bus. ( Bus driva no gree drop us
4 coppas lodge).



I bin tink say katsina capital dry but as I reach dis
village omo i no fit shout….



Small small pikin and old women dem jus comot
4rm no wia, full evriwia de shout
“‘ Kwoffa !! Kwoffa !! ‘”. (Corpers corpers)
As dem de shout naim dem de gada around us. One
coppa com do mistake comot biscuit and sweet 4rm
her bag, trow 4 de villagers. As dem rush am finish
naim anoda batch de run com wia we dey mak dem
kolet dia own share, b4 we no wetin de hapun,
crowd don full evriwia. Old mama dem and small
small pikin de scramble 4 biscuit and sweet wey we
de share. I luk my watch, 5:55pm. Dis villagers still
de gada more and more, dem no wan free us mak
we go our coppas lodge, if we wan move naim dem
gode drag our bag.


One of de coppas ( kaycee) finally call one man, ask
am 4 hausa as we go tak reach our coppas lodge
naim de man com diret us as we go take reach dia,
as we de go naim dose pikin dem still de chase us 4
bak.
We finally reach our destination. old coppas wey de
live 4 de lodge run com welcom us. omo as I see hw
dem dey, para jus hol me o, as I luk dia face nobe
pesin tell me say dis guys neva Bleep 4 many
months. Conji show wella 4 dia face.




Dem show de babes wia dia own lodge dey ( abt
15mins waka 4rm our lodge). As we settle down
finish, baff, chop, rest, naim dem com read rules 4
us (for pple wey wan live 4 de lodge). Evritin wey
dem read dia no even enta my head, de only point
wey I rememba na as dem tell us mak we no eva try
go or enta babes lodge. no mata wetin we de find.
de only time wey we go see oursef na for c.d.s or
oda days like sunday. Com tell us say na 4 our own
gud, de villagers no wan no weda u be coppa abi u
nobe coppa, dem no wan see babes and guys
2geda.



de next day naim I kari my postin leta go my P.P.A
(Government unity secondary school malumfashi).



I meet de principal, he yarn me say he go accept me
but de problem be say de coppas lodge wey dey de
skool, 8 coppas de live for de two rooms so if I go fit
manage live wit dem, no wahala.




He kari me go de coppas hous….I see de coppas….I laff 4 my mind. I de wonda as dose coppas manage
de live 4 dat kain house. De roof don spoil finish,
dem no get lite, no wota ( bt dem get food wella )
de principal introduce me 2 de ones wey dey dia,
tell dem say i be new coppa wey dem send com dia
skool and I go live dia wit dem ( since e remain jst
3-4 months mak som of de coppas pass-out ) b4 de
principal tok finish naim I tell am mak he no worry, I
go find anoda place live. De man provoke.

‘” Dis coppas wey de live hia nobe human beign
kwo ? .. I accept u 4 my skool com giv u
acomodation naim u no wan apreciate wetin I do 4
u…!!!!…u knw hw many coppas wey don com and I
reject dem…infact if u wan liv anoda place, I nogo
giv u one kobo. U go use ur money pay 4 hous
rent..!!! “‘



I reason 4 my mind, dem don already reject about
20 coppas wey I know, wey com serve for
malumfashi and dem dey stranded now. No skool
don accept dem yet. If dis man reject me 4 im skool
e go hard me 2 find anoda PPA. I tell am ok, mak I
live dia wit dose coppas. I folo de principal go bak
office, we finish evritin, me and am folo go round de
skool. he de introduce me 2 teachers as we de
waka….
…In de evening we dey outside. 8 coppas plus me 9.
Nobodi de tok. I try stat up gist..
‘” Hmm..una de try hia o…hw una de take manage 4
lite and wota hia sef ? “‘
All of dem laff. One com reply
‘” E no easy o “‘
As he tok am naim he continue de read im big book.
Odas focus bak 4 wetin dem de do ( 5 of dem de
read, 1 de pray, 1 de sing, de oda one jus put hand
4 jaw de tink wetin I no no )
I com tok de one wey wan put me 4 wahala….
“‘ So how una de take hol bodi, unto babes levels ‘”
Nobodi reply. I luk round, all of dem still busy de do
wetin dem de do. I ask again, nobodi still reply me
naim I comfort mysef say nobe evribodi de like
woman gist.
Afta sumtime i tell dem mak dem com mak we go
find somwia shayo, atleast mak I buy dem drink as
say na my 1st time……all of dem raise head wit
speed look me, naim one of dem ( de one wey bin de
pray ) stat ….



‘” Dis na de problem wey young pple get 4 dis
contri. Instead mak u use ur time do beta tin naim u
wan go waste am 4 drink and woman…. E be lyk say
u no serios 4 life ……..”‘



Dis guy jus de tok nonsense wey full im mouth, I bin
wan yab am bak wit my bad mouth bt i jus kari my
earfone, put music, leav dem dia comot go stroll
small. If I com bak I go no as me and dis strange
pple go take de live 2geda…..


To be continued

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6