SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 2

Episode 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 2

☆☆

………
Omo see as the guy dey weld koboko na, my heart skip a beat and all my clothes wet with sweat, goose pimples come full all over my body. My head was heavy and my hands and legs were shaking uncontrolably, chai omo na you this mouth put me here o.

Just then the officer come tear me slap for face.
Gbozaaaaaaaaa!

Chai my head start to ring
wimwimwim,
i see stars at once, without wasting time another slap land
gbozaaaaaaaa!!

Chai omo i no cry but tears start to run from my eyes .


“Na who you tell God to punish?”

The office come ask
“na….abeg bros no vex na……”

Before i go even finish another slap tear my face gbozaaaaaaaa!!!
Nai i pass out
i open my eyes later only to discover that i was tied like a thief.dem tie me for one straight pole come lie the pole on two pin pole. I come dey like suya for fire. Just den two officers waka pass. Go bring fire wood come put under me.

Hmmmm wetin this guys dem won do? Just then the officer wey slap me come show with one bottle of fuel. Chai my own don finish…e come put the fuel for fire wood come won start the fire nai i come ask am

“oga for your town ona dey chop human being?”


E no answer me , e just look me with e eyes , chai na real wahala i buy , my james bonds {father} go dey look for me by now. Na only boxer i wear. Nai i come ask am again
“aboki for your town ona dey chop human being?”

The next sound i hear na
gbozaaaaaa!!

Chai baba God i don die, chai my yansh, my yansh o, just then e come light the fire…i come start to smell roasted goat………..

Previous Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 1

Next Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 3

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)