SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 9

Episode 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 9

☆☆

dem start to search and search and search but dem no still see me. Nai dem come contact the camp don, just then, the camp don request for their assistance, nai dem leave my room, all the provost wey been dey for the passage dem enter inside the compound. Our own room na room 2, and na for the passage e dey. As soon as dem commot, i no wait for 1 sec o, i just come down from the bed. {as if , if na ona, ona for no take the opportunity? Laughs} come peep through the passage, passage clear, nai i put on my adidas white canvas, bro before one go say jack robinson, hmmm i don tear race, dem hear when i run , i guess them dey come for my back cause i hear chasing sounds behind me. Nai i double my already speeding engine from gear level 8 to gear level 15. I tell ona say i even break usain bolt’s record.

I outrun dem come take quick turn on reaching a sharp bend which was on the junction, {right leads to the conference hall and kitchen, left leads to commanders quaterz and front leads to the field and recreational quaterz, thank God say flowers dey there, nai i come dive under . Just then , 10 provost zoom pass. Pheeeew, i clean sweat from my face. So na only me 10 provost dey chase like thief na wa o.

Nai i come out from my hideout run go the conference hall, on reaching nai the door keeper tell me to lie down he come tear 5 lashes of koboko for my yansh. .

Atleast e better pass when those provost for catch me. Cause i know say na guard room direct dem go match me to. And guard room na one of the place i no wan go.

As soon as e flog me finish e come tell me to run inside to which i obey. I run inside join my roommates without anyone noticing it.

At was just like 15 minutes later when the camp commander come enter announce say dem come fetch some people. I mean those people wey dem been dey chase wey try escape. Chai na so my mind fly cause i know say dem go catch me this time around.

No way to escape from this particular saga. Chai am doom.

Previous Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 8

Next Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 10

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)