SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 10

Episode 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 10

☆☆

As soon as e finish talking na so searching start. From platoon 1, dem arrange out 25 recruits, same goes to platoon 2, but platoon 3 no get any casualty sha. When e reach platoon 4, dem march out 40, when e reach platoon 5 dem no fit mail anybody so dem tell us to pin down our heads. When e come reach platoon 10 omo dem march out 300 people . {guy i say dem march out all platoon 10} . Cause dem first distribute us before the punishment come start. For my platoon, my section nai be worry pass. We later elected coy leaders, section leaders, platoon leaders and a joint platoon leader. I was elected a section leader. So i was section 2 leader. So i was incharge of 4 coys. ………..backwards………later dem come march all platoon 5 out to the drilling field. By now it was quater to 6am. Non of my boys dey f--k up o, cause if one person f--k us , all the whole section if possible the whole platoon fit see s--t. So if any body for my section f--k up do make dem punish us, when we go back to our hostel, that person dey see fire, so dem no dey f--k up . {i say oga sweet die o, laughs}
we jug , run, flex, and do all kinds of physical exercises, then went into the next schedule which was lecture. Sha i was among the land combatants so our class was fun.

After training , it was 12am that a whistle for our breakfast was blown {as dey call it o, since na our morning food be that.

Na their wahala be that so na only dem know how to handle am, laughs} after eating garri wey dey like 50naira fufu for this buhari change saga, we all went to have a nap, at 4 drills start again.

Na till 7pm after we close from drill, nai actor and boss won start. Ibibi chai mowe, the almighty camp commander aka camp don vs platoon 10 commander aka camp scorpion…….as i dey recap wetin happen , my body dey sweet me die, cause throughout that day wahala flow for every where. Even food self, haha omo, abi lucky na war camp you go? You never see anything o
watch out for the fight

Previous Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 9

Next Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 11

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)