SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 15

Episode 6 years ago

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 15

☆☆

The next day, me and my appointed men, started the journey to the north esthern state. Our journey was smooth cause we were in a fleet of convoy. Guy see guns wey dem carry escort us na but dem no won give us, we couldn’t make it to maiduguri that day so we have to stop over in kaduna from there we’ll go direct to maiduguri.

Around 2am in the morning an alarm was sounded that we were under attack na so the combatants squade dem shoot gun die.

Chai just then i passed a call to the nearby army base for backup.

{Thats why i dey like my military allies o, especially army, once you wire dem call for help during an emergency, dem go show in time nomatter the distance. Dem no dey like police wey go wait till the show finish before dem go come show come dey pick innocent people wey dem go see around all in the name me questioning/investigation.

Once again to my Nigerian Army allies. Tuale for all of you o, more grease to ur gallant elbow}.

Under 5mins, army don show na there wey i know the kind job i sign up for. See as bullet dey fly for sky like diamonds na it, lasted for 2 good hours before the attackers took to their heels. By now it was 4am. My gallant army shouted for joy and were celebrating.

No more sleep again as every one was on guard. Till 6am our convoy was ready and this time army convoy follow us.

We arrive maiduguri before 11am. After the normal protocols, we were posted out to our various Outpost. Guy the next dey i was around gwosa area when bokoharam attacked us , we took cover since we didn’t have gun just as the f-----g son of a b---h have said earlier. The MOPOL men fine level.

Na my gallant ARMY allies come take the burden . Soon dem come over power these bokoharam boys nai dem {bokoharam} enter their vans run, since the army dem been no too plenty nai my boys come carry some of the army and bokoharam men guns {the ones wey die.} nai we come join the army dey chase the bokoharam. Nai our chase lead us into the almighty sambisa forest. Chai na so my moral born like hot coal. Soon we come enter their strongehold na there wey we come scatter this bokoharam dem na.

We fire gun from 9am till 4pm before we come over power dem {thank God say the army guys were extra prepare dem come with more than enough bullet} nai we come capture dem. Na me self wey capture shekeau, come tell am to surrender nai i bring am out. Come dey shout kill shekeau! kill shekeau!! kill shekeau!!!

We come dey gyrate with happiness dey go drag shekeau dey go, yes o today na today dem go make me a lieutenant colonel o or colonel not major o. And i bet the army will like to conscript me fully into a full combatant soldier.

We come reach our check point nai shekeau come free himself won run nai i come dive am down see boxing na , me wey been dey hear shekeau , people say e ugly, guy me tell ona say shekeau even fine pass aisha buhari lol.

Nai i scatter am with punch beat am black and white come finally throw am for ground come dey shout

“moral”

every body come dey respond
“high!!!”

nai i come kick shekeau throw for ground again come carry matchet wey i collect from am come raze am up , aim am for e throat, with the speed of lighten come dey bring am down with full force , yes o am on my way to stardom, shekeau just dey watch dey shake as the matchet dey descend,
{ so the almighty shekeau wey dey kill anyhow dey dear to die? Mtchew na e wahala be that so na him know the best way to handle am…}

Matchet don dey reach shekeau neck…..




THE END

Season 2 Loading......

Previous Episode

SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 1 - Episode 14

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)