Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

…..She dial d numba 1st tym, e no ring. She try am again d tin ring, my huawei china fone node disapoint 4dis kain time.
Lyk say dem blow whistle 4dem, evri bodi turn imediatly face me. I comot d fone 4rm pocket, luk d numba, cut am, raise head de luk de babe, she de luk me. Sumtin wey dey lyk fear wan enta my bodi but I com get mysef.
Wetin de hapun. Why I go fear babe wey me and am go skool d same tym, nobe say we dey skool again wey go mak am kari ha influence wicked me, she nobe my mama, she node giv me moni. She nogo fit stop me 2go service, if she com 4 fite i go beat am ( I neva sure 4 dat one o becos d babe na comfam tomboy). Dem stil de luk me lyk say I poo 4pant naim I standa…
“Yes I call u mak we hang out still no oursef wella b4 we go service, wetin bad 4wetin I tok?, u jus de insult pesin wey u no no 4fone I wonda weda ur mama train u well, I wan use my own moni tak u out u jus de tok nonsense infact u get luck say I no see u dat day becos wetin I 4don do u nobodi 4save u “. I tell am my mind wit vex. Who she be?, SUG na 4ha poket.
” U don finish?” Ochuko ask me. As I wan reply am naim she order me mak I comot 4dia meetin. I tell am say she de craze.
She command me again mak I comot, dis tym wit hot vex, ha voice don high. I tell am mak she com comot me if she get d mind. She kari ha jotter and biro wey dey tabul 4ha front, tell d mumu pple wey com d meeting say if i no comot 4rm dat meeting say she go comot. Dis mumu pple stat de beg me mak I comot, I no gree, I tell am mak she de go naim she stat de comot omo naim dia beg turn 2shout. Dem de shout giv me say if I no comot say dem go force me. I no gree. 2of d boys rush de drag me 4hand, odas de push me 4back, de worwor babe de pull me 4one leg. I bin wan use d oda leg nack am 4face comot ha teeth but I com reason say as dis babe don alredi wowo lyk dis, any oda wound 4ha face, ha own don finish. Dem kari me lyk dat comot d hall. see embarasment. I tell d mumu boys say I go get dem 1 by 1, I comot.
I use dat whole week de buy wetin I go use enta camp. Wite shoe, wite vest and all dose tins. I no 4get buy 3 paket of condom incase dose army women wan giv me Bleep ( one of my guy tok say I’m Bleep army woman wen Im dey camp but I no beliv am). Since ochuko and ha agbero dem don tok say I nogo folo dem go, no wahala. Only me go folo go.



Notin much hapun dat week except say my ex babe enta town sunday com nok 4my door, I Bleep am as we de tak Bleep b4 but wetin surprise me be say she nodey m0an and shout as she de do b4 if I de Bleep am. Wen me and am stil de date, if I de Bleep dis girl she gode cry beta cry. Tears gode comot ha eyez, she gode m0an koret m0an wey show say de Bleep de rily enta but dat sunday wey she com, as I de Bleep am she de gist me as ha sista husband tak de toast am evriday and how i go help am raise moni mak she use buy anoda fone….
Finally we com enta monday (d day wey I de go camp
I pak my bags enta ABC park mak I find car wey de go Abj (I go 4rm dia enta katsina). I join line de wait my turn, I com see say wetin full de park na pple wey still de go youth service wit me. I stil de shine eye de chek weda I go see swit babe wey de go wia i de go.
E stil remain 2pple 4my front b4 my turn reach naim pesin wey dey my bak touch me, I turn, one fair fine babe jus de smile ask me weda I de go service, I say yes. She ask me weda na Abj I de serv, I tell am say na katsina naim she tok say dem post am Abj. We jus de gist, 2 of us gree say we must sidon 2geda inside bus . E remain only one pesin mak my turn reach naim my fone ring. I pik am, e com be say na my cousin henry.
Henry senior me wit close2 4 yrs but d guy de lyk run tins wit me wella. He tell me say he de drive pass my town wan enta Abj with Im new toyota highlander say mak I com chekout d car. I beg am mak Im giv me 10mins, I rush out. Na wen I dey 4bike I rememba say i no even tell d babe wey me and am dey 4line say I de comot. I no even kolet ha numba. Since my cousin kari car, I 4don kari de babe mak we drive 2Abj 2geda. Why I too de fu-Ckup 4dis kain tins, why my brain no rememba dis tins ontym? Why? Why?.




I reach wia henry dey’ omo see sharp white toyota highlanda 2006 model wey dis guy kari com.
Henry. He kari tattoo scatta evriwia 4 im bodi, wear diamond earring 4one ear, lyk 4 rings dey Im fingas, wear givenchy eyeglass 4 eye, two big gold chain 4 neck (he tok say he buy dem 3000 dollars each). I ask am weda he sell Im honda discussion continues b4 he buy dis one, he say no, dat one still dey house.
Henry na d kain guy wey de like spend moni, buy u drink, giv u moni if u ask am but if u ask am wetin I’m de work he go tell u say he dey into many tins.
I enta car, we move. one tin wey de mak me de avoid my cousin henry b say anytime wey I dey wit am, na only babes mata he de tok. D guy no fit tok moni mata, na only babes, party, club, drink, fvck, flexing. D guy no jus serious 4 life.
D jorny jus de swit me 4bodi. d guy put A.C, de blast 2pac 4d car cd. I luk d bak seat, 3 bottles of Andre jus dey dia, I open one, pour 4rubber cup de sip. I jus de feel lyk say I dey heaven.




As we de drive pass ilesha express road, naim i see one bus wey spoil 4 side of road, d passengas dey outside de hala, weda na d driva abi anoda pesin I no no. By den d andre wey I de drink don de enta my eye smal smal, I don de adjust my seat mak I enta sleep mode.
” Na why I de hate travel 4public transport” henry tok
we don drive reach lyk 4mins naim…



” Guy abeg stop stop stop, e be lyk say I see pesin wey I no 4dat bus wey spoil”. I tell henry
” E be lyk say dis drink don de dirty ur brain, we don drive pass dat place 5mins ago na now u rememba say u see pesin wey u no”, henry tok
He com leta turn bak go d place wey de bus dey.
Ochuko sidon 4ground, d oda guys de hala shout giv am, tell am say na ha stubbornness cause all dia problem. Dem warn am mak she no hire dat bus but she no gree hear. Tell am say if she tok anytin again dem go slap am and if she do anyhow dem go kill am bury dia naim she tok say dem nogo fit do anytin, say all of dem put 2geda no reach am half naim one boy rush slap am, she slap d boy bak, d oda boys rush am, my cousin jump comot 4car,warn dem mak dem no touch am.



He ask dem wetin d mata be? Dem tell am evritin finish tok say dem must beat ochuko, he ask wia dem de go and dia skool, dem tell am. I comot 4rm car wit my andre bottle 4hand, tell henry mak we de go, our journy still far. henry look me, tell me say shebi na me tell am say I see pesin wey I sabi 4d bus, why I com de tok mak we comot again.


He enta inside car, comot 20k giv dem, say mak dem use am couple moni hire anoda car. We drive comot.
We drive sum distance naim henry luk bak, see say dose pple still de fite, I tell am mak he leav dem mak we de go, he turn bak reach wia d bus spoil, dose boys de fite wit ochuko. Henry tell am mak Im bring ha bag 4 d bus com put inside our car, she obey shap shap, jump enta our sharp toyota highlander 2006 model, we zoom comot.
I turn luk bakseat wia she dey, tears full ha eyes. Ochuko de cry….

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6