Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

….. I face front continue de press my fone. Pour
mysef anoda cup of Andre. Henry ask am weda she
wan drink she say no, we continue our jorny,
nobodi de tok 4car I com de vex say dis babe don
com put tension betwin me and my guy. See jorny
wey bin de swit me 4bodi naim dis babe wey don de
insult me since many days wan com spoil.


Henry stop, buy chiken suya giv evribodi, I from
front mirror see as dis babe de munch ha own wit
koret hunga, she jus de chop de meat lyk pesin wey
neva chop 4 3days. So dis babe kari hunga 4belle
de waka since, she get mouth call me poor student
d oda day 4 fone.


We drive enta Okenne and by den, nite don de
reach. Henry tok say I’m no wan drive 4nite say
mak we go find hotel lodge till in d mornin. We see
hotel, but ochuko tok say she nogo sleep wit us 4
room, say she go sleep inside car.
I tell my cousin say mak he see d kain wahala wey
I’m bring 4 himsef. Henry tell am say mak she no
wori, Im go pay 4room 4 am. We enta d hotel, pay 4
two rooms, enta dia bar, buy peppersoup and beer.
Ochuko tok say na malt she go drink, we buy am
malt and peppersoup.
Henry kol d barman, tell am somtin wey I no hear, d
bar mind smile comot. We still de gist about 20mins
leta naim d bar man kari one slim fine babe enta,
henry giv d bar man moni, d guy jus de shine teeth
run comot. She greet evribodi. Henry introduce me
2d babe, tok say ochuko na my babe. D babe (ha
name na oge) luk me and ochuko, tok say 2 of us fit
wella. Ochuko luk me, smile one kain shy smile. I
neva see ochko luk inocent and fine b4 lyk d way
she luk now as she smile. The babe say na big stout
she de drink, we buy am 2 bottles kip.
I tap henry, tell am say mak we see outside. As we
comot, I ask am say wetin be Im plan 4dis babe wey
he kari com. He tok say she go sleep 4 our room. I
ask am wia he want mak I sleep now?, he tell me
say mak I sleep anywia I wan sleep, dat one no
concern am. Na anoda reason I node lyk dey wit dis
guy. If I’m dey wit woman, e go be lyk say I’m brain
comot. U no say u dey wit ur guy 4room, u stil go
kari ashawo join.




As we enta bak, henry kari oge 4hand drag am up,
tell me am ochuko say dem de com, 2 of dem comot.


15mins pass, me and ochuko neva tok anytin, I com
de wonda d kain babe dis girl be. So she no even fit
tank me say we kari am 4car. Upon say we kari am
free 4car She still de do strondhead 4me.
” Hope say dose guys no wound you?”, I luk am
diret 4eye ask am.
As she luk me she com comot eye bend ha face
down slow. So dis SUG strong babe shy lyk dis.
She tell me say dem no wound am. We close mouth
continue our drink 4 silence, nobodi tok. We jus de
enjoy d slow love music 4 live band.
” Sori 4 wetin I do u d oda day” ochuko tok.
I turn bak, luk left, luk rite…., turn bak again luk,
” Na me u de tok? ” I ask am.
She com laff, tell me say na only 2 of us dey dia so
na me she de tok.
“Oh, so a whole Ochuko Ayeni, forma SUG vice
president fit say sorry” i tell am. She jus de laff,
from dia we stat de yarn. She jus de gist me evritin
about hasef. Wen she be vice presidet, ha family
and ha boyfriend. Yes she get boyfriend.
She tell me say she get serios boifriend com de tell
me as she tak luv d guy. As we de tok, ha fone ring,
she show me d caller name “my love”. Ok o.
She ansa kol finish, still de tell me about d guy, as d
guy take fine, as he tak luv am, ha boifrind dis, ha
boifrind dat. I. Com vex tell am say dis guy wey she
de die 4lyk dis fit dey somwia de Bleep anoda toto
naim she vex tell me say mak we close d topic.
45mins don pass, henry and oge neva comot 4rm
rum. I com dey worried, call am 4fone, ochuko say
mak I leav am say he de enjoy imsef. Henry pik cal
tell me say he de com, off fone.
Ochuko jus fix eye de luk as I de drink my beer. She
com tell me say mak I pour am beer 4 cup she wan
folo me drink…



Some pple de tok wetin dey dia mind only if u giv
dem small alcohol, na den dia real self go comot….



Na wetin I see wia ochuko dey …



I luk am, ask ha weda she de tak acohol, she say
she de drink wella, say only am don finish one botle
of small stout b4. I laff 4my heart, see me wey de
down 8botus of gulda neva tok, dis babe de boast
say she don finish 1botul of small stout b4.
I tell am say mak I buy am small stout, she say she
wan mak me and am share dat one, (notin vex me
pass 2 share my botul of beer wit pesin). I tell am
say I node share my beer wit pesin say ok mak I buy
am botul of beer, even if she no finish am no wahala,
as I still de tok, naim she rush wit speed kari my
beer botul de giggle lyk small pikin wey Im papa
buy new toy. I standa 4rm my chair, de go wia she
seat naim she standa 4 ha own chair de run comot
4rm our table de laff. See dis babe o, she wan mak
me and am stat de run around lyk tom and jerry 4
dis public bar. I node lyk dis kain play o .
I tell am mak she bring my botul bak if she no wan
mak I vex 4 am, she de run bak, de drink d beer 4rm
botul. I leav am go bak my tabul de sip d small one
wey remain 4cup. If I no I 4don pour plenty beer 4d
big glass cup wey dem bring 4me but i jus stingy
wit d beer, de pour am small small so dat e nogo
finish fast. As I still de find barman mak Im bring
me anoda botul of beer, if dis rude girl want mak
she chop even d botul, I no send, I see my cousin
and Im babe as dem hold hands de laff lyk fish head
de com tabul. My cousin stop d babe midway 2de
tabul, drag am 2 imsef, de kiss am wit force. I com
de wonda weda dis guy get shame at all.




Dem reach tabul sidon. I de ask henry wetin tak Im
tym lyk dat, he laff tell me say mak I ask oge. As I
face oge wan ask am naim ochuko enta tabul wit my
gulder botul sidon. I luk d botul e com b say she jus
remain small beer, henry ask am wia she from, she
jus de laff, de point me..
” He no wan share Im beer so I take am by force”
she tok as she de laff, com sidon 4ha chair wit force,
table jus shake, evribodi turn wia she dey, de luk
am.
She tok say she sori, com calm down. As I de yarn
wit Henry, ochuko kari henry small stout wey dey
table de drink, henry jus de laff, tok say na dose
kain sharp babes he de lyk. He com tell am say mak
she bring d drink mak Im buy am anoda botul, she
jus kari d drink hol 4 hand.





Henry kol d bar man say mak he bring anoda stout
4 am. As d guy bring am, open am, henry de tok 2
oge, ochuko still rush collet d stout. Henry comot
4im chair run de go ochuko seat, ochuko stand, de
laff, wan run again but change ha mind giv am d
drink.


She do d same tin d 2nd tym, as henry run de com
her chair, she stil kari d drink giv am bak. Wetin she
do com stat de vex me, I regret why I dey careless
allow am kolet my beer drink, see as she de
embarass me anyhow hia. U get lite brain de drink
beer.


Afta sum minutes don pass, As we still de yarn, e
com be lyk say ha eye don de clear small small
becos she jus quiet de press fone.
Next tin wey we see, she com tell henry say mak he
pour am Im big stout 4cup mak she drink, henry
wan pour, I vex tell am mak he no try am, henry luk
me, say mak we see two aside, drag me comot 4rm
my seat. As we comot, he tell me say I de Bleep up,
say I supose d giv de babe enuff alcohol mak she de
drink so dat she go high wella and e go easy 4me to
Bleep am, I tell am say e go beta mak babe kari ha
mind giv u Bleep if she wan giv you nobe wen u use
shayo mak am weak, I no suport dat 1. Henry use
vex say na why he node lyk involve me 4 any of Im
moni paroles, say I too de fear, he leav me dia
comot.
As we reach wia d oda babes dey, ochuko de tok say
she no say we don go use am gossip, anytin wey we
use ha name tok she go no, henry ask am how she
go tak no, she tok say na me go tell am. Hmm. Wen
dat one com stat. We still de tok naim she stil kolet
henry drink , as henry wan run comot 4 Im chair lyk
mumu chase am ( e be lyk say de game don de
sweet am sef), my badt boy sense com tell me
somtin…




I tell henry mak Im wait, I comot 4rm wia I dey, de
go wia ochuko stand. As I de com, she de go bak, I
run de chase am, she de run de comot outside. I
turn bak go sidon. She still com bak again.
Henry tell am mak she giv am Im drink, she no gree,
he rush go wia she dey, she jus laff giv am d drink
bak.
Na dia I tak get de message. Dis babe de show me
green lite since but I jus de dull lyk learner.
Haha.
Ochuko U don enta one chance 2day….

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6