Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

….. Evribodi finally settle down de drink in peace.
Henry de feed oge meat 4mouth lyk say na Im real
babe, ochuko de chop ha peppersoup wit malt,
barmen de waka up and down de find pple wey go
kol dem, oda customas scatta evriwia 4 de bar, I see
one old man wey kari one small girl wey go young
pass Im last born 4 laps, d small girl jus de romance
am 4head, d man de laff lyk mugu. Na dis kain men
go enta dia hous de beat dia pikin dem anyhow.
Guys and babes dey evriwia 4 d bar. Som de gist de
laff loud, some de tok small small. I see as one babe
and one guy enta d bar, dem argue small, de guy
leav d babe wit vex comot 4 de bar. Hmm. Who no
wetin de quarel dis 2 lovas.
D live band wey dey dia still de play dia music.
Evriwia jus mak sense.
As oda pple de enjoy diasef 4dis koret bar wit de
fresh air, live band and enuff shayo…

……Me dey my chair de pray mak ochuko kari my
gulder botul run comot again….

But e be lyk say d green lite wey she bin de show
me don turn 2 red. Big red lite.
” Why u de luk me lyk dat”, ochuko catch me as I de
luk am. I wonda as dis babe tak see say I de luk am
4dis kain place. Hw she tak see my eyes 4dark.
I lie 2 am say I node luk am but d babe sure say she
see my eyes.
I ask am weda she still wan drink beer, she say no.
Nawao. See yawa.
I finish d last drink wey dey d botul, call ochuko
mak she com I wan yarn am sometin outside. She
tell me say mak I tell am anytin I wan tell am, she
node comot go anywia. Wetin dis babe de benefit
4rm sturbonness. I shift my chair go ha side, tell am
say d problem wey dey now be say my cousin and
Im babe go sleep 4 one rum, I nogo fit sleep dia wit
dem and i no get anyoda place wey I go sleep so me
and am go sleep 4 d same room.
As I tok finish, ochuko de luk me lyk say I don tok
abomination, com enta serious laff. She laff laff laff
sotey me confuse. I ask am wetin de mak am laff,
she stop, luk me 4 face, continue de laff me. Henry
ask am why she de laff lyk mad woman, she tell am
mak he mind Im bizness say e get sumtin wey I
yarn now wey she wan undastand well.
She com face me….
” So na una plan b dis abi. Mak me and u sleep 4 d
same bed dis nite? 9months leta u go deny say nobe
u giv me belle. Na wetin u want abi?. E nogo work
4u.”.
I com vex. See dis babe wey we don de help since
aftanoon, kari am all d way 4rm ilesha reach hia, giv
am beer, buy am peppersoup, pay 4hotel rum 4 am,
she de drink our beer since, de embarass us hia,
plus all d insult I don receiv 4rm am since, she still
get mouth de tok dis nonsense hia.
” So wetin u wan mak I do now?, wia u wan mak I
sleep?”. I ask am
” No wahala. Kari de room key go sleep. I dash u de
rum. Mak only u sleep, but if na mak me and u sleep
2geda, dat one na ova my dead body. I go sleep
inside car, if ur broda no gree, I go pay 4 room
4mysef. I kari de moni.”
“Guy shebi I don tell u mak u node boda dis babe
becos of room, she wan sleep alone, leave am. Me,
u, oge go sleep 4 one rum”., henry tok. Dem don de
luk us since as we de argue. I wonda wen henry tak
tell me dis tin wey Im tok now. Wetin henry tok vex
me. Why he gode lie say Im don tell me mak I node
boda ochuko becos of rum. Why he gode lie 4my
front lyk dat. I standa 4rm wia I dey, kari my fone
4table, tell henry mak Im giv me car key mak I go
listen music inside car. I leav dem dia comot.



I comot 2pac plate wey dey d Cd, put luther
vandross, put ingition , on A.c, wind up glass, adjust
d passenga seat wey I de so dat I lie on am, de
enjoy d A.c and luther vandross wey I put. As cold
don de catch me I com off d A.c, wind down small.
I don dey dia lyk 20mins naim pesin tap 4 window….
I wind down…
Security man say mak I park car well mak pesin
comot. I obey d man.
10mins leta I hear anoda tap 4window. why dis
security man de disturb me lyk dis dis nite. He say
mak I park well, I obey am, I sure say place wey I
park dey gud becos I luk wella b4 I park dia. Why
he still de disturb me, infact why evribodi de
disturb me dis nite.
De pesin nock again d 2nd tym. I lower d C.d
volume, wind down d window…
ochuko jus stand dia.
“I wan join u inside car”. She tok, wit mixture of
command and beg 4 ha voice….


So de disgrace u giv me inside neva do u abi” I ask am. She reply me say if I de open door mak I open, if I no wan mak she enta mak I tell am mak she go bak inside. I tell am say I no lock door, mak she open am enta. She say mak I open am 4 am, I tell am say she neva serios, raise de song volume, turn d oda side. I no say she go standa dia de luk me. Afta sum tym, i turn my head right again mak I no weda she still de dia but I no Pour see am again. Maybe she don enta inside, dat 1 node boda me, as I say mak I comot head 4window no weda I go see am around naim I hear am open driva side enta, fear catch me small o. ” Sori as I take tok 2u inside”, she tell me. ” Na d 2nd tym u de apologis dis nite alone, so if me and u dey 2geda till next week naim b say u go apologis reach 1milion times”. I reply am. She jus smile, ” Nobe say I de apologise 4 wetin I tok. I node tell u sori 4 wetin I tok but I jus de apologise becos of how I tok am. E nogo gud mak me and you sleep 2geda, mak we avoid temtation abeg”. She tell me wit low voice. I tell am say I don hear, comot face again. “I no say u go de vex 4 me. Since wey me and u sabi oursef na so so quarel and fite we de fite.”. Ochuko tok ” I hapi say u no. Sumtyims I gode wonda weda u be babe abi u be guy wey wear woman cloth. See as u de behav. u too proud, u too sturbone, u no get respet, u too de fite. See as u de fite wit dose boys 2day, wat if dem wound u, wat if dem damage ur eyes, or disfigure any part of ur bodi, u tink say na me go com mari u”. She com laff, I ask am why she de laff, she tell me say nobe 2day she don de hia wetin I tell am, she de hear am evriday. I tell am mak she try change, she tok say she go change but mak I forgiv am 1st, I tell am say I node kari anytin 4 mind 4 am. Evriwia com quiet. we jus dey silent de enjoy de music 4rm C.d player, nobodi de tok. Imediatly one idea enta my head. I tell am say if say she don rily change, I go want mak we celebrate am. Two of us only. “How”, she ask me. I put hand 4bakseat comot one andre wey dey dia, giv am cup, open am, pour 4 am, pour 4 mysef as luther vandross de blast 4 speaker. We jus de sip am de gist about evritin, de gist about notin. She say mak I tell am about my babe. I tell am say I no get, she com tok say she no say na wetin I go tok, say no guy go eva gree say I’m get babe.I tell am say I no get, she say mak I close mouth. I kari face troway d oda side, she stil de yarn. At a tym she com ask me why I node tok again, I no reply. She ask again and again, kol my name, I no ansa am. She com tell me say mak I no vex 4wetin she tell me, I no still tok. She com close mouth. Afta sum seconds pass, I luk am, she bendown ha head, tell am say she no supose de tok 2pple anyhow. She tell me say she sori, I luk am.. ” Sori numba 3″ I tell am, She laff, say mak I pour am wine. As I de pour am, she use ha left hand draw me 4 shirt near ha bodi, som wine pour 4 d skirt wey she wear. As our face near each oda, she call my name, say if I no say I don rily 4giv am mak I kiss am. I ask am wia I go kiss am, she smile, say mak she show me, com draw ha face near my own. Ha nose 1st touch my nose, next tin I feel ha hot breath 4 my mouth. She wrap ha warm lips 4my own, I still de wonda wetin de hapun, she com use ha tongue slide pass my lips enta my mouth de find my own tonge, na den I com get mysef, open my lips welcom ha own lips. Since I stat de kiss babes I neva see one wey ha lips soft reach ochuko own. Our kiss com increase. The heat inside our mouth com de rise, she de kiss me de sU-Ck my lips and my tongue. 4 my mind I still de wonda weda na rily ochuko ayeni de kiss me lyk dis abi na anoda pesin. Lyk say she read my mind, she stop de kiss, hold me 4 face de luk me lyk say she de read som tins 4my face. As she still de luk, I kari my hand fold am 4bak of ha neck, bring am close wia I dey, stat de kiss am again, she also hold me tite 4bak of my head de kiss me bak wit full force. As she de kiss, she de rest ha bak 4 d car door, de drag me ontop ha bodi, I de folo am, I now hang ontop am halfway as she sidon 4 driva side. We still de kiss, ha soft lips jus de sU-Ck my own hard, I no fit get enuff of ha swit lips, we de kiss lyk pple wey kissin don de hungry 4 many years…. ” Chaii! Omo see beta kiss oo”. Na Henry voice. De babe push me comot ontop am, de smile lyk small pikin wey shame de catch, turn ha face down. ” Abeg I no wan disturb una o, I jus wan kolet sumtin 4boot, mak una put A.c nah”. I tell am say I don hear mak he de comot. b4 I no wetin de hapun, ochuko don wind up evri window, I put A.c, she jump enta bakseat. De wait mak I join am …

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6