Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

“lokoja expressway wey de dey busy evritym jus be
lyk say dem de fite serios war dia.
tyre jus scatta evriwia 4 road. Cars park left and
rite, wit drivas and passengas inside, som cars de
turn bak. Henry jus park car one side de wait. We
com observ say no car de com from front, we wait
som mins, we no still see any car wey de com. We
ask pple wey dey around, som tell us say na
robbers, som tok say na riot, som say dem no no( I
wonda why dem folo odas park).
20mins pass, evriwia still dey as e dey naim henry
tok say he node wait again, ochuko de beg am mak
I’m wait small atleast mak we see weda any car go
pass, I tell am mak im use im head well de do anytin
he wan. henry start car enta road.


….As we don drive reach lyk 45mins, no car neva
still pass us, evriwia still dry, cold. weather com de
change lyk say e wan rain, next tin, water com de
drop ontop our windscreen. Thunder de blow,
evriwia com dark lyk say nite wan com. D water de
dey drop smal small, next tin e com increase, no see
Heavy rain. We tink say d rain go slow down but d
more we de drive de go, d more de rain de heavy.
De increase.
Henry see say de rain don pass am, Im wiper node
gree kari d rain again, d more Im de wipe, de more
d rain de heavy 4 d wiper, he say mak Im clear 4
road park well. we park 4 road de gist. 20mins pass,
rain still de fall, ochuko don sleep, my eyes don de
heavy. I luk henry, Im eyes don de close, sum
seconds leta evribodi 4 car enta serios sleep…… 4
middle of place wey we no no… 4 dis kain bad
time…
GBOwAAAA!!!!!!!!
Na d loud noise wey wake evribodi 4rm sleep. (By
den rain don stop)One tall man wey wia wite gown
use axe scatta d window glass wey henry siddon. I
jump up, ochuko de shout, henry hol de axe de try
kolet am 4rm d man, de strugle wit d man, Blood
full henry hand I comot 4rm car , rush de man. .


Wen d man see say our power don pass Im own
naim I’m stat de shout
“Ku dinga zo mana” (mak una de com)
Henry de shout mak I run enta car mak we comot, I
kolet d axe 4rm de man, push am down, raise de
axe de tink wetin I go do. De man still dey ground
de tok sum tins I no undastand. I kick de man 4 leg.
Kick am again, as I turn wan enta car naim dis man
hol me 4leg.
I de try mak I free mysef 4rm d man hand, Im no
gree, I hear pple wey de shout de com I turn bak
omo see lyk 10 pple kari matchet de run com wia
we dey. Henry comot 4rm car help me pull leg
comot 4rm de man hand, we run enta car, ochuko
de cry and i de try calm am down.
Henry stat car, as we de move, we tink say we don
ecape 4rm d wahala wey catch us, next tin we hear
na ‘GBOoOOM’. Our 2 front tyres don burst. D car
de kari us enta bush but henry jus de try control
am. D more we de speed, d more d car de put head
inside bush, I hear noise, I turn bak see say dose
same pple de com wit 2 bikes. 3 of dem dey 4 one
bike de oda 3 dey 4 d oda bike, all of dem kari
cutlass and axe de de shout giv us say weda we
stop abi we no stop, dem go catch us comot our
head. Ochuko de cry de regret why she folo us
comot. D worst part b say na only us de drive 4
road. No oda car de com, no oda car de go. Road jus
clear, two bikes de chase toyota highlander.


By den de tyre don tear finish. Na only d metal
wheel de roll 4 road now de mak enuff loud noise. d
car don de slow down small small. D way dose guys
de behave, if dem hol gun dem 4don shoot us since.
Dem de trow us bottle, stone, stick evritin, de shout
evritin wey dem go do us if dem catch us. Omo d
kain tins wey dis pple de tok say dem go do us even
stat 2de para me. We dey only 3 pple, we no even
kari ordinay kitchen knive tlkless of cutlass. Dose
pple many, dem kari enuff weapon, dem deadly lyk
wetin I no no, dem don tok say dem go behead us if
dem catch us, say dat one na notin wia dem dey.
Our car don de slow down, dia bike de near us wit
force. Road still dry, no car de com yet, evri bad tin
wey I don do 4lyf de flash 4my mind, ochuko close
ha eyes de pray, tears jus de flow lyk water 4 ha
eyes, henry de sweat lyk xmas goat.
I tok say anytin wey go hapun, I go mak sure say I
use my last strenght fite 4my lyf. Henry say mak i
turn check weda I go see any car wey de com 4
bak, as I turn mak I chek naim henry shout…
” Guy Bend down fast” !!!!!!!. Henry use one hand
hol me 4 neck, shift am down, use d oda hand de
control steering. One of dose men use axe scatta d
window glass wey de myside, if say I no bendown
on tym dem 4don use de axe scatta my head main
main. I no say wahala don burst as dem don reach
our car. Ochuko de cry lyk small pikin 4bak de beg
dem, na dat tym I raise my head luk dis pple wella.


All of dem black lyk devil, use red scarf cover 4rm
dia nose down, dia eyes red lyk say dem pour blood
inside, omo fear catch me sotey I de shake lyk
v’ibra/tor.
De one wey dey middle put hand 4 door wan open
am 4rm outside, henry de try drive comot 4rm dem
but car still de push am go wia dem dey. As de guy
open de door small omo i put hand 4 bak seat, use
one Andre bottle wey dem neva open nack de guy 4
hand naim d one wey dey bak comot Im sharp
cutlass mak Im use chop my head comot, I no fit do
anytin, I de luk de devil as Im de comot matchet
4rm sack, standa 4 bike, hol Im broda 4 sholda mak
Im position well, I’m eyes fix 4my eyes, jus one tin
dey our mind, na dat matchete wey Im raise go
comot de life wey dey my bodi, and na now e go
hapun.
As I’m don position wella raise hand wan strike,
henry use force match break, dem pass us, still turn
bak again, by den d oda group don reach our car, all
of dem comot dia weapons de shout(4dia mind Dem
don see meat). D ones wey dey front now stat de
com wia we dey wit speed, by den d steering don
stiff, henry de use all I’m strenght de try control de
car bt d tin jus de stress my man.

….As dose pple still kari speed de com 4 front, we
still de com wit force, wetin we see….one of dem
comot one short daggar, standa 4 de bike, de rotate
am round and round wit I’m hand, next tin….he fling
d dagga diret 2 us, mak Im scatta our windscreen,
thick bush dey 4 right, deep pothole 4left.
he swerve de car immeditly go left, wia de pothole
dey. By den d devils wey trow us d dagga don ride
pass us, Our car crash enta d pothole. Evritin stop.
I no com de hear ochuko voice again. I turn bak luk
am. Ochuko don faint since.
Henry de try stat d car but e no gree, I wan open
my door atleast prepare 4 d killers wey don de com
wit leg 4 bak, de shout, de jump up. As I de try open
door, d tin no gree open again. e com be say sumtin
hook d door from d pothole. I de try force am open
but e no gree, by den d dem don de reach wia we
dey.



As I de try comot 4rm d window wey dem don
break, henry open I’m door, comot outside, as dose
pple see am dem tink say he wan run naim dem
increase dia speed, de near us wit full force, blood
full dia eyes. Dem don de kill tey tey so 2 waste our
own life no mean anytin wia dem dey.
Henry open boot, comot wetin I no eva expet fit dey
my cousin car… One black double barrel pump-
action….
He raise de gun, pump am. Dose pple standa dia de
luk am, he com face de gun wia dem dey naim all of
dem run scatta diffrent diretion, he blow de
pumpaction diret wia dem dey but dem get luck say
bullet no touch any of dem. He blow am up again,
release anoda bullet. We no see dem again.



We wait 15mins, we no see any of dem. We enta
car, use water wake ochuko, she jus de ask wetin
de hapun, wia she dey, why blood full 4 henry hand.


We jus de try calm am down.


20mins leta, one bus drive pass, we de wave am 2
stop bt d man no stop. Anoda car pass. 10mins leta
naim police patrol team de pass, dem see us stop,
ask us wetin hapun. We tell dem evritin, dem help
us wave one bus down, we enta.
We reach d next town, buy tyre, call mechanic.
In de next 2hrs we don kari our highlander, scratch
all ova d bodi de drive enta Abuja…….

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6