Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

we finally enta Abj. Afta we don drive for hrs.


Henry
drop us wia we go see car, Im and ochuko hug, I tell
am say we go tok 4fone, he comot de go Im way.




We
enta car, me and am dey 4d last seat 4bak.



As we dey road, I jus de rememba evritin wey don
hapun. I luk ochuko, she comot eye, as I face front,
use corner of my eye de luk am I com see say she
de luk me, I go luk am, she comot eye again naim I
turn ask am why she de avoid eye contact wit me,
she tok say she no wetin dey my mind and na why
she de shame 2 luk me 4face.


I tell am say she no nid shame. any babe wey see
wetin she see as we de com Abj go still faint
10times or even die sef, say mak she free ha mind
4de matta. She jus de luk me, kip silent. Afta sum
seconds she open mouth wan tok somtin, close
mouth again. She com tell me say nobe wetin she
wan tok.


“Mak we free evritin wey hapun 4 lokoja express
road, d main tin be say nobodi die”. She tell me.
I ask am wetin now mak am de avoid my face. She
luk me, comot eye again
” Wen we dey okenne…..inside ur cousin car…..I no
say u go tink say I be loose girl but nobe so e be…..”
” Ochuko, I no say u nobe loose babe, I de even feel
say na me b d loose guy sef as i no control mysef” I
tell am
We continue our jorny 4 silent. Nobodi de tok, I de
press my fone, put earpiece, ochuko face window
de luk outside. I com de wonda why dis babe node
boda about as we tak escape 2die, wetin com de
boda am na how I take Bleep am inside car.



Nawao.


So e mean say ochuko value toto pass ha lyf.
She com touch me, I comot my earfone, she de luk
front de smile..
“I enjoy am” she tok
” U say?” I ask am
” I say I enjoy am”.
“Wetin u enjoy?” I ask am again
” As u take Bleep me inside car” she reply. As she
tok am, de old woman wey dey my side luk am one
kain eye lyk say she wan use eye luk ochuko die. I
luk de woman, smile 4 am but she frown comot
face.
” I no say u enjoy am na why u com my rum again ”
I tell am. She laff.




As she tak laff com be lyk say dem pour ice water
4my heart becos e don tey wey I see ochuko laff lyk
dat.
“Hmm, I de envy ur babe o. If say na lyk dat u de
take Bleep am naim be say she nofit leav u go folo
anoda man. So gist me, na so u de Bleep ur babe abi
u jus wan impress me”. She ask me
I luk am mak I sure say na ochuko de tok dis kain
tins. I no beliv say ochuko fit tok lyk dis. I tak style
luk de old woman mak I no weda ha attention dey
wia we dey b4 I reply dis serios JamB quesion..
” U wan tell me say ur guy node Bleep u well, even
if …….”.


Ha face change lyk pesin wey de vex..
“I don tell u mak u node tok anytin wey concern my
guy mata if we de tok” she warn me. I com vex. Dis
babe de tok anytin wey she wan tok wia I dey, she
de ask me about my babe evritym so why she gode
vex anytime I mention ha guy.

” Ochuko, since u no wan tell me anytin about ur
guy, I gode tok about am evritime. I no say u luv am
wella but I nobe babe wey wan snatch ur guy 4rm
u, i node drag anytin wit ur guy so I wonda why u
gode why u de protet am lyk dis”.. As I tok finish,
she jus de luk me, wan tok somtin, e com be lyk say
she Change mind. She open mouth again 2 tok, she
close mouth. Next tin she turn face window. She
put hand 4 ha bag comot hanky de wipe ha eyes…

“Ochuko, wetin b de mata. Ok no vex. I no wan knw
about ur boyfriend mata again o abeg”. I de beg am.
She turn face me, tears dey ha eyes, I still de tink
wetin I go tel am
” U wan no about my boyfriend abi” ..
” Noooo…. Ochuko nobe lyk dat…ok yes I bin wan
no b4 but I don change mind. I no wan no again…”
Omo I jus de beg o
” My guy nofit last pass 5mins. We don try evritin,
go evriwia, mak we see weda we go fit do anytin
wey go help am but notin de work. I nogo fit enjoy
my boyfrind if we de Bleep, once I’m prick touch my
toto he go release imediately”
I joke tell ochuko say I no blame I’m guy, ha toto
too tight and hot so any prick wey enta dia nogo
last, D joke no just funi d babe.
She tell me say she 4don leav d guy tey tey but she
luv d guy wella, and he get money well well. ( I com
de wonda d one I go beliv wey mak am still dey wit
de guy, na becos say she love am abi becos say d
guy hol moni). As I still de tink naim henry call me
4fone say mak I giv ochuko fone..
As dem tok finish naim she jus de laff..
” Dis ur broda sef”
I ask am wetin b d mata naim she tok say henry tell
am mak she resend dat ha friend numba wey she
giv am ystday, say he no no wia he rite d numba
again…..


7hrs 35mins leta, we land katsina state. Katsina
wey I hear say if dem catch u de even think about
toto, na beta koboko 4 u. If u do mistake luk babe
nyash omo u go luk 4 ur fingas u nogo see dem o. If
dem catch u and babe wey nobe ur wife de waka 4
road or dem see una 4 private place ( weda una de
pray, gist or play), ur hand and leg don go bedat. E
com b say dem catch u de Bleep toto, weda she be
ur babe abi she nobe ur babe omo naim b say u don
lost ur head 4eva.
As we reach park omo d tins I see around me fear
me nobe small. Men jus full evriwia. D small babes I
see na de ones wey kari purewater and kunu 4head
de sell. Oda ones still de hawk fruit and oda tins but
u no nid peson 2 tell u say d men wey dey dis town
node laff atall atall. I com de tink as I go tak manage
mysef 4de town. See me wey if I neva Bleep toto for
2weeks e go be lyk say oxygen and water don dry
4my bodi. hw I go tak survive one whole year 4dis
town wey Im men de vex lyk dis, how I go tak Bleep
toto 4dis kain place. Wia I go even see toto wey I go
Bleep. Wetin I do fedral govment wey mak dem wan
wicked me lyk dis?. How I tak do Nysc bad wey mak
dem put dis kain suffer 4my head….


we comot 4rm bus wit our bags de wait 4 taxi wey
go kari us enta orientation camp, I still use style de
observ enviroment mak I no weda I go see anytin
wey go sweet me 4eye, 4wia. Evribodi wear agbada,
babes wear dia hijab, sum even cova dia whole bodi
4rm head 2 leg wit dia hijab. Oda people wey de go
d camp wit us still de come, evriwia jus dey
‘beautiful and decent’ (as my pastor friend 4 camp
go tok).

I comot fone mak I call one of my guys wey don
serve 4 katsina mak I ask am if ashawo joint dey
4de state at all but I com advice mysef say mak I
relax, d guy fit de luk me one kain eye.


” Com If ur plan na 2 sleep 4dis park 2day jus
comot me 4ur plan o. See as u de shine eye evriwia
lyk say na jupiter u com, abeg mak we find taxi wey
go kari us reach wia we de go b4 nite com”. Na
ochuko voice. I dey wia I de tink toto 4get say me
and pesin folo. I tell am say na bike I de find, as she
still de luk me de wonda wetin dey my mind, I call
one mallam wey de sell mai dabino ice cream , buy
2 mak I use de cool my brain since I don search wia
I go buy beer I no see.
I luk my watch, 6:10pm. Darkness don de com small
small, ochuko sidon 4ha big bag de rest, indigenes
wey de pass de luk us lyk say we 4rm anoda planet
com, evri shop don de close one by one, taxi men
wey we de call node gree stop. D ones wey stop de
tok say wetin we go pay dem na times 3 d normal
price becos of hw town dey and e don late.



evribodi



de rush enta dia hous…. Nobodi wan mak curfew
catch am.
Curfew… Anybodi wey still dey outside by 6;30pm,
na enuff wahala 4 am. We de try reason d taxi men
say we be corpers, dem de ask us wia our cap and
khaki dey, we de try xplain say na wen we enta
camp naim we go get dose ones, 4wia, dem jus wan
mak we kari all our moni giv dem 4 transport. I no
send giv dem any amount wey dem tok becos nite
don de com but na ochuko wey jus de insist say she
no evritin as dem de tak charge 4 transport, say
nobodi fit chop warri babe lyk am. I remind am say
nite don de com, she de hala me say naso evribodi
gode chop me mugu anyhow, say if I no no wetin I
go use moni do mak I giv am. She tok say even if we
no see car wey go kari us 4 dat park, she get anoda
plan…
6:20pm, d whole park don dry. cars wey remain no
pass 2 and pple don hire dem finish. Nobodi de even
ask us wia we de go again… Ochuko luk watch,
comot ha fone 4 bag, chek time…
“Oghene eee!!!,, yeee !!!.” She de shout.
she say mak I tell am wetin de nak 4my time, I yarn
am, naim she com tell me say ha watch stop since
5:20pm. Ok…
” U don see say taxi don finish 4 park. U tok say u
get anoda plan wey we go use reach camp. Wetin b
d plan?” I ask am.
She tok say e get anoda park wey dey across de
street, wey ha sister tell am. we go see car wey go
kari us enta camp.
We kari our bags reach d park wey she tok, evriwia
dry. We no see car, we no see pesin, notin at all… I
turn luk bak, pple don de disappear one by one, I
luk time, 6;45pm….
Curfew don catch us b dat..

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6