Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

“‘ Anita !! I tink say u no wan com inside b4 …..

Wetin mak u change ur mind ‘” I ask am
“‘ Hmm. No jus tok wetin go mak me comot again
o… U de shakara 4 me abi “‘ she reply
“‘ Baby nobe so o, sleep bin de catch me so I say
mak I jus close eye small…bt if say…..”
“‘ Okay o’ If sleep de catch u mak I de go na…mak e
nobe say I de disturb ur sleep. We go see anoda
time “‘.



De babe stand mak she comot I jus stretch hand
grab am 4 hand…
‘” Oya sorry. Abeg No comot, d sleep don clear 4 my
eye. “‘


She jus laff sidon 4 bed again. She no tok I no tok.



She sidon 4 bed edge, I lie behind ha back. Finally I
com brek d silent..
“‘ Wetin mak u tear dat kain race sef …?”
”’ Abeg abeg abeg …nobe wetin I com discuss
here … If na wetin u wan tok jus tell me nw mak I
comot ….”‘ She ansa me
“‘ See as u jus de use say u wan comot de threaten
me… See anita if u wan comot, door dey open
o..wetin de do u sef mtcheew”‘
She no tok. She jus de look me. I de wonda weda
she go standa 4rm bed comot abi she go still dey
dia. I no wan giv am chance mak she even decide,
naim I trow anoda quesion..
‘” Bekky bin tok say wen una dey skool u no gree
date any guy, u no get dia time. Na true? “‘
Dt one sweet am, she com shift inside adjust hasef
wella as she de smile de boast..


“‘ Why I go date all dose small boys, hmmm..


Dem
no even see my face, I node folo anybody laff den o
hmm. Ask bekky nah, infact na only bekky I de folo
tok 4 skool den…..”‘
I de listen as anita jus de gist me abt ha skool life.



Anita wey stubborn lyk wetin I no know. She still de
tok naim i cut am short, call ha name, wit low voice
“‘ Anita. I no jus no wetin I do u 4 dis camp, eva
since d 1st day I see ur face na only u dey my mind
bt u de post me up and down…I don fall in love wit
you but u no wan open ur heart 2 me. Baby abeg
open ur heart mak u see say me na 4 real….'”.




I de yarn wetin I no no wia dem 4rm enta my mouth
naim She continue again…
‘” So de lecturer enta class o, say mak I comot…say
if I no comot, im nogo teach again….hmm, naim de
whole class…..”
‘” Anita u no hear wetin I tok?, I de tok anoda tin u
de tok anoda tin. Wetin de do u .”‘ I de hala am.
‘” I don hear nah…shey u say mak I open my
heart?., leta we go go find knife or razor cut am
open …hahahahaaha.”‘
Dis babe jus de laff me. Use me de play. I close
mouth, turn face wall again naim she still continue
ha tori. She com see say I node listen again naim
she call me, I no ansa am. She call me again, ask me
weda I de vex, I no reply am. She say if I no reply
am again say she go jus comot and she nogo tok 2
me again.



Anita call me again I no ansa am naim she standa,
use speed comot blanket wey I use cova mysef..



She catch me again. Dis time my prick no rise bt my
hand dey inside my short, 4 my prick…
‘” Oh !! I de waste my strenght de gist u since naim
u dey bizzy here de romance ursef ….haii!!! Anita u
don suffer ‘”
She jus focus ha eyes 4 my hand bt I no even boda
comot my hands inside my short….


‘” See dis guy o ! U no even get shame. Upon say I
dey hia u no still wan comot ur hand 4rm wia u put
am “‘
“‘ Y I go shame? Nobe my prick?, abi na ur toto I de
touch ‘” I bold reply am.



She sidon again 4 bed. Com tok
‘” See…dis tin wey u de do now, na ursef u de
suffer. if u touch ursef finish u go still kari conji go
sleep so e beta mak u jus free ursef….if na me de
cos am abeg no vex mak I de go ‘”
She wan standa again naim I rush wit speed drag
am 4 waist, she fall enta my bodi again, dis time she
lie down across my laps, ha back 4 my laps, she
face me as I dey 4 sitting position.



She jus dey still… She no move. Wit de dim light
wey dey our room i see as she de look me diret 4 my
eyes…i no no wetin I go do wit dis babe now, but na
must, I go do sumtin.


I shift am slowly comot 4 my bodi, kari am gently
like egg place 4 bed. I com de bend my head down
wia ha own dey….she still de luk me, I de lower my
head mak i kiss ha face….she com finally tok..

“‘ Wetin u tink say u wan do? “‘

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6